Library · pcm

Proverbs 8

8:1 Make una hear mi! Wisdom dey koll pipol and undastandin wont make dem hear en vois. 8:2 Dem dey on-top di hill near di road! Dem stand for di oda side for di road. 8:3 Dem dey near di gate dey koll pipol wey dey enter di town sey: 8:4 “Wi dey beg and koll evribody wey dey di world. 8:5 Una wey nor know anytin, make una get wisdom. Una wey nor wise at-all, make una try get sense. 8:6 Make una listin to mi! I get betta words to tell una and na di rite words I dey tok so. 8:7 Wetin I dey tok so, na trut; bikos I nor dey lie. 8:8 Evritin wey I tok na true; I nor dey lie or dey lead una go die. 8:9 My words dey klear and evribody wey get wisdom, go undastand dem. 8:10 Instead of silva, make una take my words; make una choose wisdom, instead of di gold wey fine pass. 8:11 Na mi bi wisdom; I betta pass gold; nor-tin una wont wey good each mi. 8:12 I bi wisdom and I get sense well-well; I still get knowledge and I dey judge well. 8:13 If to sey una dey fear God, den una go hate bad tins. I hate pride, pipol wey dey tok anyhow, bad-bad tins and lie-lie words. 8:14 Kommon sense and suksess na my own. Na mi get undastandin and pawa. 8:15 I dey help kings rule well kon make rulers give korrect laws to dia pipol. 8:16 All di ruler for dis world dey rule with my help, even ofisas and prince dem too. 8:17 I love only doz wey love mi; anybody wey dey look for mi, go si mi. 8:18 I get propaty, honor, betta life and suksess to give pipol wey wont am. 8:19 Anytin wey una get from mi, betta pass di gold wey fine pass and silva wey pure well-well. 8:20 I dey follow korrect judgement and I always dey do wetin dey rite, 8:21 and doz wey love mi, I dey give and pak propaty full dia house. 8:22 From biginnin, na mi God first kreate, before E kreate evry oda tin. 8:23 God kreate mi before di world start. Na mi E first give life to. 8:24 Dem born mi before God make di sea or kreate wota. 8:25 Dem born mi before God make di mountins, even before E put di hills for where dem dey. 8:26 I dey before God kreate di eart, en fields or even di first san. 8:27 I dey der wen E put di sky for where e dey kon draw di boundary between eart and sea. 8:28 I still dey wen E put di kloud for sky; open di wota for di sea 8:29 kon orda sey make di wota wey dey di sea nor full pass as E kommand am. I dey der wen God lay di eart foundashon. 8:30 I dey near am like pesin wey dey design house before dem build am. Na mi dey make am happy evriday and I dey happy for en present. 8:31 I dey dance for di world wey E kreate kon dey happy with human being too. 8:32 So, make yong pipol listin to mi naw kon do wetin I tok and dem go dey happy. 8:33 Make una listin to wetin I dey tish una kon get sense. Make una nor rijet dem. 8:34 Make blessing follow di pesin wey dey listin to mi. Evriday, e dey wosh my gate and dey wait mi outside my house. 8:35 Doz wey find mi, go get life and God go favor dem. 8:36 But doz wey nor find mi, dey wound demsef and anybody wey hate mi, love to die.”