Library · pcm

Numbers 23

23:1 Balaam kon tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi, den bring seven melu and seven ram.” 23:2 So Balak do wetin Balaam tok. Balak and Balaam kon give one melu and one ram as ofrin for each altar. 23:3 Balaam tell Balak, “Make yu stand for here near yor burnt ofrin and I go-go pray and anytin wey God show mi, I go tell yu.” So only Balaam kon go on-top di hill. 23:4 God kom meet Balaam and Balaam sey, “I don build di seven altar and I don give one melu and one ram for each one.” 23:5 Den God tell Balaam, “Go back go meet Balak, tell am wetin I tell yu.” 23:6 So Balaam go meet Balak for where en stand (near en burnt ofrin), both en and all di prince dem for Moab. 23:7 Den Balaam profesai kon sey: “King Balak for Moab bring mi kom from Aram, from di mountin wey dey di east kon sey, ‘Make yu kom help mi curse Israel pipol.’ 23:8 Na how I wont take curse pipol wey God nor curse? Or how I go take distroy wen God nor send mi? 23:9 I dey si dem from where I stand on-top di rock; I dey look dem from di hill. Dem bi one nashon wey dey stay alone; dem know sey dem dey bless pass oda nashon. 23:10 Who go fit kount Jakob dust, dem too many to kount. Make I die as God pikin; make I die in peace as betta man.” 23:11 Den Balak tell Balaam, “Wetin yu do mi so? I sey make yu help mi curse my enemy, but yu kon dey bless dem!” 23:12 Balaam ansa, “Na only wetin God tell mi, I go fit tok.” 23:13 Balak kon tell am, “Abeg, follow mi go anoda place where yu go si some Israel pipol, den help mi curse dem from der.” 23:14 So Balak take Balaam go Zofim field, on-top Pisgah, where e for build seven altar kon give one melu and one ram for each of dem. 23:15 Balaam kon tell am, “Make yu stand near yor burnt ofrin and I go-go pray to God.” 23:16 God kom meet and tell Balaam, “Make yu go back go meet Balak kon tell am wetin I tell yu.” 23:17 Wen Balaam kom back, e si sey Balak still stand near di burnt ofrin, with di prince dem for Moab. So Balak ask, “Na wetin God tok?” 23:18 Balaam kon profesai, “Make una kom! Balak wey Zippor born, make yu kom hear wetin I dey tok. 23:19 God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi. 23:20 E don kommand mi make I bless dem and wen God bless pesin, I nor go fit shange am. 23:21 Wahala nor go happen to Jakob shidren; Israel pipol nor go si trobol. Bikos di Oga wey bi dia God dey with dem and na-im bi di king. 23:22 Na God take dem komot from Egypt; E dey fight for dem like wiked melu. 23:23 Nobody fit curse Jakob shidren; majik nor fit wound Israel pipol. And pipol go tok about Jakob sey, ‘Si di wonderful tins wey God don do for Israel pipol!’ 23:24 Israel pipol go bi like strong lion wey nor dey rest until e don distroy en enemies kon drink di blood of di pesin wey e kill.” 23:25 Den Balak tell Balaam, “As yu nor gri curse Israel pipol, den make yu nor bless dem!” 23:26 But Balaam ansa, “I nor tell yu sey na wetin God tell mi, na-im I go do?” 23:27 Balak tell Balaam, “Abeg make yu kom; I go take yu go anoda place. May bi God go allow yu curse dem from der.” 23:28 So Balak take Balaam go on-top Peor for di wildaness. 23:29 Den Balaam tell Balak, “Make yu build seven altar for here for mi kon bring seven melu and seven ram.” 23:30 So Balak do wetin Balaam tell am kon give one melu and one ram for each altar.