Numbers 24
24:1 Wen Balaam si sey God wont make e bless Israel, e nor kon go meet God as before, but e turn waka go near di wildaness.
24:2 As Balaam look up, e si Israel pipol kamp akordin to dia tribe and God Spirit kon enter en body.
24:3 Den e start to profesai: “Balaam wey Beor born, naim message bi dis; di man wey en eyes open well-well, na en word bi dis;
24:4 di man wey dey hear wetin God dey tok. Pesin wey dey si vishon from God, even as en eye open. So e sey:
24:5 ‘Si as Israel tent fine, di place where Jakob dey stay!
24:6 Dem bi like long valley; like gardin wey dey near wotaside. Dem bi like aloe wey God plant and cedar tree wey dem plant near wota.
24:7 Dem go get enough rain and dia shidren-shidren go plenty like river; dia kings go get pawa pass Agag and pipol go praiz dia kingdom.
24:8 God take dem komot from Egypt. E dey fight for dem like wiked melu. Dem kill and break sturbon pipol bones kon shuk dem with arrow.
24:9 Di nashon bi like strong lion; wen e dey sleep, nobody fit wake am. Anybody wey bless Israel pipol, go dey bless and anybody wey curse Israel pipol, curse go follow am.’ ”
24:10 Den Balak kon dey vex well-well for Balaam, so e klap en hand kon tell Balaam, “I koll yu make yu kon curse my enemies, but si, yu don bless dem three times!
24:11 So naw, make yu dey go! I sey I go pay yu well; but naw, God nor wont make I pay yu.”
24:12 Balaam tell Balak sey, “I tell di messenjas wey yu send to mi sey,
24:13 ‘Even if yu give mi yor house with all yor silva and gold, I nor go fit disobey God kommand to do evil or good just as I wont am, but na anytin wey God tell mi, I go tok.’
24:14 I dey go meet my pipol naw, but make I warn yu about wetin dis pipol go soon do yor pipol.”
24:15 Den Balaam profesai sey: “Balaam wey Beor born, naim message bi dis; di man wey en eyes open well-well, na en word bi dis;
24:16 di man wey dey hear wetin God tok, wey know di tins wey dey di Most High mind; di one wey dey si vishon from di Almighty, even as en eye open. So e kon sey:
24:17 ‘I don si am, but nor bi naw e go happen; Even doh I hold am, e nor dey near my hand. One star go kom out from Jakob pipol. E go kom out from Israel like septa. E go kill Moab pipol and Seth sons.
24:18 E go take-ova Edom town and propaty; den Israel pipol go win.
24:19 Dem go bring leader from Jakob house and e go distroy di pipol wey remain for di town.’ ”
24:20 Den Balaam look Amalek pipol kon profesai: “Before-before, na Amalek strong pass among di nashons, but e go skata forever.”
24:21 Den e look Kenite pipol kon profesai: “Where una dey stay strong well-well and dey save like bird house on-top tree.
24:22 But dem go distroy Kenite pipol. How long Asshur go use una as slave?”
24:23 Den e profesai kon sey: “Yes! Na who go dey alive wen God don do all dis tins!
24:24 Strenjas go kom from Cyprus kon ovakom Assyria and Eber, but dem too, go die forever.”
24:25 Den Balaam and Balak kon go dia house.