Library · pcm

Numbers 25

25:1 Wen Israel pipol dey for Shittim, dem kon dey sleep with Moab wimen. 25:2 Dis wimen invite di pipol kom dia juju festival; den di pipol chop and woship dia juju. 25:3 Bikos Israel pipol join dem woship Baal-Peor, God kon dey vex well-well for dem. 25:4 God tell Moses, “Arrest all di leaders kon hang dem before di Oga for aftanoon, so dat mi God nor go vex for Israel pipol again.” 25:5 So Moses tell di judge dem wey dey Israel sey, “Each of una must kill doz men among una wey dey woship Baal-Peor.” 25:6 At wons, one Israel man bring one Midian woman enter di tent where Moses and di whole kommunity for dey kry. 25:7 Wen Finehas wey Eleazar born, Aaron di priest grand-pikin si am, e komot from where all di pipol gada, take spear 25:8 follow di Israel man enter en tent, den kill di two of dem. So di wahala wey dey distroy Israel pipol kon stop. 25:9 Doz wey die for di wahala na 24,000. 25:10 God tell Moses: 25:11 “Finehas wey Eleazar born, wey bi Aaron di priest grand-pikin don remove my vexnashon from Israel pipol, wen e do dat tin wey e do and naim make mi nor distroy dem wen I dey vex. 25:12 So make yu tell am sey: ‘I go gi-am my kovenant wey dey bring peace. 25:13 Na en get am and en shidren go bi priest forever, bikos e take en God sirious kon make mi forgive dis pipol.’ ” 25:14 Di Israel man wey dem kill with dat Midian woman, na Zimri wey Salu born, wey bi leader for Simeon tribe. 25:15 Di Midian woman wey dem kill, na Cozbi wey Zur born. Zur na leader for Midian tribe. 25:16 Den God kommand Moses, 25:17 “Make yu attack and distroy Midian pipol, 25:18 bikos dem bring wahala to una wen dem deceive una koncerning Peor and bikos of Cozbi, wey die for di time wey Peor bring wahala enter una land.”