John 10
10:1 “Na true word I dey tell una, pesin wey nor pass door enter di place where dem dey keep sheep, but klimb pass anoda side enter di place, na big tif.
10:2 Di pesin wey pass di door enter, na-im bi di shepad wey dey guide di sheep.
10:3 Di gateman go open di door for am and en sheep go hear en vois wen e koll dia name and e go lead dem kom out.
10:4 Wen e don bring all en sheep kom out, e go-go dia front and di sheep go follow am, bikos dem know en vois.
10:5 Dem nor go gri follow strenja, but dem go run from dem, bikos dem nor know di strenja vois.”
10:6 Jesus tell dem dis parabol, but dem nor undastand wetin e tok.
10:7 So Jesus kon tell dem again, “I dey tell una true word. Na mi bi di door wey di sheep go must pass enter.
10:8 All di pipol wey kom before mi, na big tif dem bi and di sheep nor go gri listin to dem.
10:9 Na mi bi di door, anybody wey enter thru mi, God go save am. E go-go inside and out and e go si betta grass chop.
10:10 Di tin wey tif dey do, na to tif, kill and distroy pipol, but mi, I kom so dat pipol go get life, di kind life wey full well-well.
10:11 “Na mi bi di good shepad. Di good shepad ready to die for di sheep.
10:12 Di pesin wey dem hire nor bi di shepad and bikos nor bi en get di sheep, e go run wen e si lion dey kom, so di lion go skata di sheep, kon kill di ones wey e katch.
10:13 Bikos di pesin nor kare for di sheep, go run leave dem.
10:14 “Na mi bi di good shepad, I know di sheep wey bi my own and dem know mi too.
10:15 Bikos my Papa know mi and I know am, naim make mi ready to die for di sheep.
10:16 I get oda sheep wey nor dey here. I must gada dem too and dem go listin to my vois, all of dem go dey togeda and na one shepad go lead dem.
10:17 Na dis bi di rizin wey make my Papa like mi, bikos I ready to sakrifice my life, so dat I go fit get di life back again.
10:18 Nobody go fit take my life from mi, but na mi go put am down by mysef and I get di pawa to take am back again. Dis na wetin God kommand mi to do.”
10:19 Anoda big kworel kon happen between di Jew pipol bikos of wetin Jesus tok.
10:20 Many of dem kon dey sey, “Demon dey inside am and en head nor korrect. Why una dey listin to am sef?”
10:21 Odas kon sey, “Di pesin wey get demon nor go fit tok like dis. No demon fit make blind pesin si.”
10:22 Di time for di Dedikashon Feast for Jerusalem kon rish.
10:23 Dat na di time wey rain dey fall (and kold dey strong well-well) and Jesus kon dey waka inside di varanda where Solomon for dey take breeze, wey dey inside di temple yard.
10:24 Di Jew oga dem gada round Jesus, kon ask am, “How long yu go make us dey wait? If na yu bi di Christ, make yu tell us.”
10:25 Jesus ansa dem, “I don tell una and una nor bilive. Di tin wey I take my Papa name dey do, dey bear witness for mi.
10:26 But una nor bilive mi bikos una nor bi my sheep.
10:27 My sheep dey hear my vois and I know dem and dem dey follow mi.
10:28 I don give dem life wey nor dey end and dem nor go ever die. Nobody go fit take dem komot from my hand.
10:29 My Papa wey give dem to mi big pass evribody and nobody go fit take dem komot from my Papa hand,
10:30 bikos mi and my Papa, na one.”
10:31 Di Jew oga dem kon pick stone again, won kon stone am.
10:32 So Jesus tell dem, “I don do many good tins wey una si from my Papa, wish one make una won stone mi so?”
10:33 Di Jew oga dem ansa, “Wi nor won stone yu bikos of di good tins, but na bikos yu wey bi ordinary pesin, dey make mout sey, yu bi God.”
10:34 Jesus ask dem, “Una law nor tok sey, I sey, ‘Una bi gods?’
10:35 If dem koll di pipol wey God send en word go meet, sey, ‘Dem bi gods’ and God word nor go ever shange,
10:36 Why una dey tell di pesin wey God choose for ensef and wey E send kom dis world sey, Yu dey tok against God, bikos I sey, ‘I bi God Pikin?’
10:37 If I nor do di tins wey my Papa send mi, make una nor bilive mi.
10:38 But if I dey do dem, even if una nor bilive mi, make una bilive di tins wey I dey do, so dat una go know and undastand sey, I dey inside my Papa and my Papa dey inside mi too.”
10:39 So dem try again to katch am, but e kon waka leave dem.
10:40 Jesus go back kon cross Jordan River, where John for baptize pipol and e kon stay for der.
10:41 Many pipol kom meet Jesus for di place. Dem bigin dey sey, “Even doh John nor do any mirakle, but evritin wey e tok about Jesus, na true.”
10:42 And many pipol for di place kon bilive Jesus.