Library · pcm

John 11

11:1 E get one man, en name na Lazarus and e nor well. En with Mary and Marta, en sistas kom from Betany. 11:2 Na dis Mary pour perfume for Jesus leg, kon klean dem with en hair. 11:3 So di sistas kon send message go meet Jesus sey, Oga God, yor friend wey yu love well-well nor well. 11:4 Wen Jesus hear di message, e kon sey, “Dis sickness nor go kill Lazarus. E go make God and en pikin get honor.” 11:5 (E klear sey Jesus love Marta, Mary and Lazarus well-well.) 11:6 Afta e hear sey Lazarus nor well, e stay where e dey for anoda two days. 11:7 Den e kon tell en disciples, “Make wi go back to Judea.” 11:8 But en disciples ask am, “Tisha, nor bi di place where di Jew pipol won for kill us yu sey make wi go again so?” 11:9 Jesus ansa, “Evriday get twelf hours wey lite dey take shine, so pipol nor dey fear to waka, bikos dem dey si well-well, as e bi sey lite dey. 11:10 But pesin wey waka for nite, go fit fall, bikos e nor get lite to si road.” 11:11 Den Jesus tell dem, “Awa friend Lazarus dey sleep, but I won go wake am up.” 11:12 Di disciples sey, “Oga God, if e just dey sleep, den e go wake-up.” 11:13 (Dem tink sey, wetin Jesus mean bi sey, Lazarus just dey sleep, but wetin e mean bi sey, Lazarus don die.) 11:14 So e tell dem sey, “Lazarus don die. 11:15 I happy sey I nor dey der, so dat una go get anoda shance to bilive mi. Make una kom make wi go si am.” 11:16 So Tomas, (wey bi Twins) kon tell di oda disciple, “Make wi follow am go, so dat wi go die with am.” 11:17 Wen Jesus rish Betany, dem kon tell am sey e don rish for days wey dem beri Lazarus. 11:18 (Betany na about two mile from Jerusalem, 11:19 and from der, many Jew pipol kon salot Mary and Marta, bikos of dia broda wey die.) 11:20 So wen Marta hear sey Jesus dey kom, e kon waka go meet am, but Mary sidan for house. 11:21 Marta tell Jesus, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die. 11:22 But I know sey, God go give yu anytin wey yu ask am.” 11:23 So Jesus tell am, “Yor broda go wake-up again.” 11:24 Den Marta sey, “I know sey e go wake-up again for di resureshon day.” 11:25 Jesus ansa am, “Na mi bi di resureshon and na mi dey give life. Anybody wey bilive mi go get life even if e don die 11:26 and di pesin wey bilive mi for dis life, nor go ever die. Marta, yu bilive wetin I tok so?” 11:27 Marta kon ansa, “Yes! Oga God, I bilive sey yu bi Christ, God Pikin, wey kom dis world.” 11:28 Den Marta go meet Mary, en sista kon tok for en ear sey, “Di tisha dey here and e won si yu.” 11:29 Wen Mary hear wetin e tok, e kon get up go meet Jesus. 11:30 Jesus still dey outside di village wen Marta go meet am. 11:31 Wen di pipol wey kom salot Mary si as e waka komot kwik-kwik, dem kon tink sey na Lazarus grave e for dey go kry, so dem follow am. 11:32 Wen Mary si Jesus, e fall for en front kon sey, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die.” 11:33 Jesus kon si as Mary and di oda pipol dey kry. So e sorry for dem and di tin pain am well-well. 11:34 E kon ask dem, “Where una beri am put?” Den dem tell am, “Oga God, kom make wi show yu.” 11:35 Jesus kon kry. 11:36 Di pipol wey kom salot dem kon sey, “Jesus love dis man well-well o-o.” 11:37 But some among dem sey, “Dis man wey make blind man si, e nor fit do make Lazarus nor die?” 11:38 Jesus sorry for dem again, den e waka go di grave. (Dis grave na big whole inside rock wey dem take big stone kover). 11:39 Jesus kon sey, “Make una remove di stone.” Marta wey bi Lazarus sista kon sey, “Oga God, by dis time e go don dey smell, bikos e don rish for days wey dem beri am.” 11:40 Jesus tell am, “I nor tell yu before sey, ‘Yu go si God pawa, if yu bilive mi?’ ” 11:41 So, dem kon roll di stone komot from di grave mout. Den Jesus look heaven kon sey, “Papa, I tank Yu sey Yu dey always hear mi and dey do di tins wey I ask from Yu. 11:42 I know sey Yu dey always hear mi, but I dey tok like dis, bikos of di pipol wey stand here naw, so dat dem go bilive sey na Yu send mi.” 11:43 Wen e don tok dis finish, e kon shaut, “Lazarus, kom out!” 11:44 Den Lazarus kom out, but di klot wey dem take beri am still kover en body. So, Jesus tell dem, “Make una luz di klot komot for en body, make e dey go.” 11:45 Den many pipol among di Jew pipol wey follow Mary go di grave bilive Jesus, wen dem si wetin happen. 11:46 But some among dem go meet di Farisee pipol kon tell dem wetin Jesus do. 11:47 Den di priest oga dem and Farisee pipol kon koll di kansol memba dem togeda, ask dem, “Wetin wi go do, since dis man dey do plenty mirakles? 11:48 If wi let am kontinue like dis, evribody go bilive am and di Roman govnor go kom take di place wey wi dey woship and awa kountry.” 11:49 Den won among dem wey en name bi Kaiafas, wey bi di High Priest dat year kon sey, “Una bi fool wey nor undastand wetin dey happen. 11:50 Una nor know sey e betta make one man die for evribody, dan sey make evribody for dis kountry die?” 11:51 (Dis man tok like dis, bikos naim bi di High Priest dat year. E tok true sey, Jesus go die for di whole Jew pipol, but e nor know wetin e tok, 11:52 and nor bi for only di Jew pipol, but make all God shidren, wey dey di world for gada togeda.) 11:53 So from dat day, dem kon dey plan to kill Jesus. 11:54 Bikos of dis, Jesus nor kon dey waka for Judea as e dey do before, but en and en disciples kon go stay for di town wey dem dey koll Efraim, wey near wildaness. 11:55 Wen Passova Feast don near, many pipol for di kountry go Jerusalem, kon dey make demsef klean for di feast, as dia tradishon tok. 11:56 Dem bigin dey look for Jesus kon dey ask each oda inside di temple yard, “Wetin yu tink, e go kom for di feast?” Abi yu nor tink so? 11:57 (By dis time, di priest oga dem and di Farisee pipol don give orda sey, anybody wey know where Jesus dey, make e kon tok, so dat dem go-go katch am).