Library · pcm

2 Thessalonians 1

1:1 Na Paul, Silas and Timoti rite dis leta go give God and Jesus Christ pipol wey dey di church for Tesalonika. 1:2 Make grace and peace wey God awa papa and Oga God Jesus Christ dey give, dey with una. 1:3 Wi get betta rizin to dey tank God evritime for una, bikos una faith dey grow more-more and di love wey una get for each oda, dey grow too. 1:4 So, bikos of una faith and how una dey bear wahala and sofa, wi dey use una boast to all di pipol for God church. 1:5 Dis na sign sey God dey give korrect judgement. E wont make una dey good to inherit en kingdom and na bikos of dis kingdom, una dey sofa so. 1:6 E good as God dey ponish di pipol wey dey trobol una. 1:7 And una wey dey sofa so, God go give wi and una rest wen Christ go kom from heaven with en mighty angels. 1:8 Den Christ go use fire wey nor dey kwensh take ponish doz wey nor know God and wey nor dey obey wetin wi dey prish about am. 1:9 God go distroy dem and dia ponishment nor go ever end. Wen Christ go kom receive glory from di pipol wey e choose, 1:10 e go drive sinnas komot from en present, en pawa and en glory. Dat day, evribody wey bilive, go praiz am and true-true, una bilive evritin wey wi tell una. 1:11 Na dis make us dey always pray for una sey, as God koll una, E go make una dey good and evry good tin wey una wont, go happen to una thru en pawa, so dat una work wey una dey do with faith, go komplete. 1:12 So, bikos of una, pipol go dey praiz awa Oga God Jesus Christ and akordin to awa God and Oga God Jesus Christ grace, unasef go dey receive en blessing.