Library · pcm

2 Thessalonians 2

2:1 Naw my brodas and sistas, for di time wen Jesus go kom and wen God go gada us go meet am, wi won tell una sey, 2:2 make fear nor dey una mind or spirit; even doh wi tell or rite give una sey Christ go soon kom. 2:3 Make nobody deceive una. Bikos dat day nor go kom until trobol go first kom and true-true, di pesin wey God go distroy, go kom out. 2:4 E go oppoz and karry ensef pass God and oda tins wey pipol dey woship. E go even sidan for God Temple dey tok sey e bi God. 2:5 Una remember sey wen I dey with una before, I tell una all dis tins. 2:6 And una know wetin dey stop am, bikos e go only kom out wen en time don rish. 2:7 Dis wikedness don already dey work for sekret and dem go dey sekret until di pesin, wey bi di Holy Spirit wey dey whole dem, go komot for road. 2:8 Den evribody go know who dis wiked man bi and God go distroy am with breeze from Christ mout kon beri am with di glory wey dey kom. 2:9 Di wiked man go kom with Satan pawa and e go do difren mirakles and wonders. 2:10 E go use wayo deceive doz wey go perish, bikos dem nor won love and respet di trut wey for save dem. 2:11 So God go make dem deceive dis pipol well-well and dem go bilive dia lie-lie. 2:12 Den God go distroy dem, bikos dem enjoy sin instead of di trut. 2:13 But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut. 2:14 E koll una enter en salvashon thru awa message, so dat una go fit get share for Christ glory. 2:15 So, my brodas and sistas, make una stand well for groun kon whole wetin wi tish una tait; weda na thru di words wey wi tok or letas wey wi rite. 2:16 Naw I dey pray sey, God wey love and give us betta konfort thru en grace and hope, 2:17 go enkourage and give una pawa for all di good work wey una dey do or di words wey una dey tok.