1 Timothy 2
2:1 First of all, I tell una make una dey pray, ask and tank God for evribody.
2:2 Make una pray for kings and doz wey dey rule, so dat wi go fit live for peace, get betta karata and good life with fear for God.
2:3 Dis kind tin good and na wetin God awa Savior dey like,
2:4 bikos E wont make evribody dey save and undastand di trut.
2:5 Bikos na only one God dey and na Jesus Christ wey kom as human being, bi di pesin wey dey bring God and human being togeda.
2:6 E die so dat evribody go dey free. Na dis message God go give di world, wen di time don rish.
2:7 Na dis tins make God choose mi as prisha, apostle and tisha to Gentile pipol, so dat I go prish faith and wetin bi trut (na true word I dey tell una so, I nor dey lie).
2:8 So, I wont make evribody dey pray for evriwhere, dey raiz dia holy hand without vexnashon or kworel.
2:9 I wont make wimen dey dress well with sef kontrol. Nor make yeye hair style; nor wear too mush gold or stones and klot wey dear well-well.
2:10 Instead, make dem get good karata as wimen wey dey fear God, suppose bi.
2:11 Make wimen dey kwayet and listin well as dem dey learn.
2:12 I nor allow woman tish or give dem authority ova men. Make dem kwayet dey listin,
2:13 bikos na Adam God first kreate, nor bi Eve.
2:14 And nor bi Adam, Satan deceive. Satan deceive di woman and na so sin take kom dis world.
2:15 But God go save di woman wen e won born, so-far e kontinue to get faith, love, holiness and dey kontrol ensef.