1 Timothy 3
3:1 Dis na true word: If any man like to bi leader, na betta work e wont.
3:2 Leader for church must bi pesin wey nor get fault; wey get only one wife; fit kontrol ensef; get sense and respet; dey welkom pipol and e bi good tisha.
3:3 Make e nor bi drunkard or pesin wey like to fight; but e must dey gentol. Make e nor bi pesin wey like to kworel or love money.
3:4 E must bi pesin wey dey manage en own house well and dey make en shidren obey and respet am.
3:5 If pesin nor fit manage en own house, na how e go take manage God church?
3:6 Who won bi leader must bi pesin wey get strong faith, bikos if e nor strong for faith, e go start to karry body up, den Satan go ponish am.
3:7 Pipol wey nor dey di church must dey tok good about di pesin wey bi leader, so dat dem nor go disgrace and make am fall enter devil trap.
3:8 Like dis too, deakons must bi pipol wey get good karata; nor bi pipol wey dey play wayo; dey drink anyhow or love money.
3:9 Dem must bi pipol wey get mind and dey prish di trut about di faith wey God don show us.
3:10 Before dem go choose deakons, make dem test dem well-well. If dem pass di test, den dem fit serve as deakons.
3:11 Like dis too, dia wifes must get good karata, nor bi wifes wey dey lie or gossip, but dem must fit dey kontrol diasef and dey honest for evritin.
3:12 Deakons must dey faithful to en wife and must fit kontrol en shidren and evritin for en house.
3:13 Doz wey don serve well as deakons, pipol go respet dem well-well and di faith wey dem get for Christ, go dey strong.
3:14 I dey rite all dis kommand to una naw, even doh I dey hope to kom si una soon,
3:15 so dat if I nor kwik kom, una go know how pipol suppose bihave for God church, wey bi di true pila and foundashon.
3:16 Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.