Library · pcm

Joshua 15

15:1 Di land wey dem give Judah tribe akordin to dia family, long from Edom borda go rish Zin Wildaness for Negev wey dey sout. 15:2 Dia borda for sout start from di sout-side for di Salt Sea 15:3 go rish Akrabbim Ascent sout kon cross go Zin, till e rish Kadesh Barnea sout kon cross from der go Hezron on-top Addar and e kom down for Karka. 15:4 Di land cross go Azmon, till e rish Egypt wotaside kon end for di sea. Na dis bi di borda for sout. 15:5 Di borda for east na from di Salt Sea go rish Jordan River. Di borda for nort start from di Salt Sea from Jordan River mout 15:6 go rish Bet-Hoglah, den cross di nort for Bet-Arabah go di Stone wey bi Reuben pikin, Bohan own. 15:7 E kom from der go Debir from Akor Valley den turn face nort go rish Gilgal (wey dey opposite Adummim Pass for di sout-side for di valley) kon cross En-Shemesh wota go rish En-Rogel. 15:8 E from der go Ben-Hinnom Valley go rish di lowland for Jebus for sout (wey bi Jerusalem) and from der, e go on-top di hill opposite Ben-Hinnom Valley for west wey dey di end for Refah Valley for nort. 15:9 E from der go on-top di hill go rish di spring wota for Neftoah, plus di whole town for Mount Efron, den from Mount Efron to Baalah (wey bi Kiriat-Jearim). 15:10 E turn from Baalah face west for Mount Seir kon cross di lowland for Mount Jearim go nort (wey bi Kesalon), den land for Bet-Shemesh kon cross go Timnah. 15:11 E still from der go Ekron lowland for nort till e rish Shikkeron, den cross go Mount Baalah, till e rish Jabneel kon end for di sea. 15:12 Na Mediterranean Sea bi di borda for west. And na dis bi di borda for Judah tribe and family. 15:13 Kaleb wey bi Jefunneh son from Judah tribe, dem gi-am Kiriat-Arba (wey bi Hebron), just as God tell Joshua. (Na Arba bi Anak papa.) 15:14 From der, Kaleb porshu Sheshai, Ahiman and Talmai wey bi Anak shidren 15:15 kon attack Debir pipol. (Before-before, dem dey koll Debir pipol Kiriat-Sefer.) 15:16 Kaleb kon sey, “Di pesin wey go win Kiriat-Sefer, I go gi-am my dota Aksah, as en wife.” 15:17 Wen Otniel, Kenaz pikin wey bi Kaleb broda win am, Kaleb kon give en dota, Aksah to am as wife. 15:18 One day Otniel kom meet and beg Aksah make e ask en papa for some land. Wen e kom down from en donkey, Kaleb kon ask am, “Na wetin yu wont.” 15:19 E ansa, “Abeg, make yu give mi one special gift. Since yu don give mi land for Negev aria, make yu give mi spring wota.” So en papa kon gi-am both di spring for up and di one for bottom. 15:20 Dis na di land wey dem give Judah tribe and dia family: 15:21 Dis towns dey Judah land end for sout near Edom borda and dem bi: Kabzeel, Eda, Jagur, 15:22 Kinah, Dimonah, Adadah, 15:23 Kedesh, Hazor, Itnan, 15:24 Zif, Telem, Bealot, 15:25 Hazor-Hadattah, Keriot Hezron (wey bi Hazor), 15:26 Amam, Shema, Moladah, 15:27 Hazar-Gaddah, Heshbon, Bet-Pelet, 15:28 Hazar-Shual, Beersheba, Biziotaya, 15:29 Baalah Lim, Ezem, 15:30 Eltolad, Kesil, Hormah, 15:31 Ziklag, Madmanna, Sansannah, 15:32 Lebaot, Shilhim, Ain, Rimmon and dem bi twenty-nine big and small towns. 15:33 Dis na di towns wey dey di lowland: Eshtaol, Zorah, Ashnah, 15:34 Zanoah, En-Gannim, Tappuah, Enam, 15:35 Jarmut, Adullam, Soko, Azeka, 15:36 Shaaraim, Aditaim and Gederah (or Gederotaim) and dem bi fourteen big and small towns. 15:37 Zenan, Hadashah, Migdal-Gad, 15:38 Dilean, Mizpa, Jokteel, 15:39 Lakish, Bozgat, Eglon, 15:40 Kabbon, Lahmas, Kitlish 15:41 Gederot, Bet-Dagon, Naamah and Makkedah and dem bi sixteen big and small towns. 15:42 Libnah, Eta, Ashan, 15:43 Jeftah, Ashnah, Nezib, 15:44 Keilah Akzib and Maresha and dem bi nine big and small towns. 15:45 Ekron and all di towns wey dey near am; 15:46 from Ekron west, evribody for Ashdod aria and dia towns; 15:47 Ashdod and doz wey dey near am, plus Gaza with doz wey dey near am, go rish Egypt Stream and di borda for Mediterranean Sea. 15:48 Dis na di towns for di kountries for hill: Shamir, Jattir, Sokoh, 15:49 Dannah, Kiriat-Sannah (wey bi Debir), 15:50 Anab, Eshtemoh, Anim, 15:51 Goshen, Holon and Gilo and dem bi eleven big and small towns. 15:52 Arab, Dumah, Eshan, 15:53 Janim, Bet-Tappuah, Afeka, 15:54 Humtah, Kiriat-Arba (wey bi Hebron) and Zior and dem bi nine big and small towns. 15:55 Maon, Karmel, Zif, Juttah, 15:56 Jezrel, Jokdeam, Zanoah, 15:57 Kain, Gibeah and Timnah and dem bi ten big and small towns. 15:58 Halhul, Bet-Zur, Gedor, 15:59 Maarat, Bet-Anot and Eltekon and dem bi six big and small towns. 15:60 Kiriat-Baal (wey bi Kiriat-Jearim) and Rabbah and dem bi two towns. 15:61 Dis na di towns for desert: Bet-Arabah, Middin, Sekakah, 15:62 Nibshan, di Salt towns and En-Gedi and dem bi six towns. 15:63 Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.