Joshua 16
16:1 Di land wey Joshua give Josef shidren na from Jordan River side go rish di wotaside for Jeriko east; den to di desert and from Jeriko go di kountry for di hill wey bi Bethel.
16:2 Di borda for sout wey from Bethel go Luz kon cross go Arkite aria for Atarot.
16:3 E from der go di west side for Jafletite aria and di low arias for Bet-Horon and Geza kon end for di sea.
16:4 Dem give Josef shidren, Manasseh and Efraim dia own part for di land.
16:5 Di aria wey dem give Efraim and en family na: di east for Atarot-Addar go rish top of Bet-Horon.
16:6 E from der go di sea and Mikmetat for di nort. E still from der go di east side for Taanat-Shiloh kon cross go Janoah east.
16:7 E from Janoah go Atarot and Naarah kon tosh Jeriko till e rish Jordan River.
16:8 From Tappuah, e go di west side for Kanah Valley den e end for di sea. Dis na di land wey Joshua give Efraim tribe akordin to en family.
16:9 Di big and small towns wey dem keep for Efraim family inside Manasseh aria dey join.
16:10 Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.