Library · pcm

Job 14

14:1 “Na short life na-im man wey woman born get and na trobol full am. 14:2 Wi dey grow and dry kwik-kwik like flower; wi dey vanish like shadow and nor-tin dey remain. 14:3 Yu dey open eye look dis kind pesin? Yu go gri judge mi so? 14:4 No klean tin fit kom from wetin nor klean like human being. 14:5 Yu know as human being life bi from di biginnin. Even di nomba of dia days wey dem go live, Yu don setol am and Yu nor dey shange. 14:6 So make Yu live us alone make wi rest! Wi bi like pipol wey dem hire to work, so allow us finish awa work with peace. 14:7 “Tree wey dem don kut for groun get hope, bikos e fit still grow again and e nor go die. 14:8 Even if di rut don old and dia part dem don dey die, 14:9 wen wota tosh am, e go grow like seed wey dem just plant. 14:10 But if pesin die, na di end bi dat. Dem don die; so where dem dey naw? 14:11 Like wota wey stop to flow and river wey dry, 14:12 na so too pipol wey die nor go kom back again. Dem nor go fit si di sky for day time again, bikos dem don sleep go. 14:13 “I wish sey Yu go hide mi for where dead body dey; den wen Yu nor dey vex again, Yu go remember mi. 14:14 If pesin don die, e fit kom back to life? But I go wait for betta time wen dis trobol don pass mi. 14:15 Den, Yu go koll and I go ansa and Yu go kon like mi wey Yu use yor hand take make. 14:16 “Naw, bikos na Yu dey kount my steps, Yu nor go kount my sins again. 14:17 Yu go forgive and kover my sins. Yu go tie dem put for bag. 14:18 Just as mountin dey fall and rocks dey move from where dem dey. 14:19 Just as wota dey wosh stone klean and heavy rain dey wosh di san, na so too Yu take distroy awa hope for life. 14:20 Yor pawa strong pass awa own. Yu porshu us komot for dis life. Wen wi die, Yu dey make us resemble anoda tin. 14:21 Even if awa pikin win award, wi nor go know, bikos wen pesin don die, e nor dey know wetin dey happen again. 14:22 But en body go pain am and en soul go kry for am.”