Job 15
15:1 Den Elifaz wey kom from Teman kon tell Job:
15:2 “Pesin wey get sense dey tok anyhow? Abi di east wind fit make am beleful?
15:3 No wise pesin go tok as yu dey tok so or sey en dey rite with en yeye words?
15:4 Yu nor dey fear God? Yu nor dey respet am at-all?
15:5 Na yor sin dey kontrol yor mout and na yeye words yu choose to tok.
15:6 E nor get any nid for mi to kondemn yu; bikos only yor words don kondemn yu.
15:7 Na yu bi di first man wey dem born? Dem don born yu before God kreate di mountins?
15:8 Yu dey hear di plans wey God dey make? Na only yu get human being sense?
15:9 Wetin yu tink sey yu know wey wi nor know? Wetin yu feel sey yu undastand, wey wi nor undastand?
15:10 Wi learn and get awa sense from old pipol; pipol wey dem born before yor papa.
15:11 God konfort too small for yu? Abi en gentol words nor rish for yu?
15:12 Wetin make yu nor dey rizin well again? Wetin make yor eyes dey weak,
15:13 sotey yu dey tok all dis kind words, bikos yu dey vex for God?
15:14 Any human being fit dey klean? Anybody fit dey rite before God?
15:15 God nor even bilive en own angels, bikos dem nor klean rish for en eye,
15:16 how E won take bilive man wey dey drink bad and wiked tins like wota?
15:17 If yu go gri listin, I go esplain give yu. I go ansa yu from wetin I know.
15:18 Pipol wey get sense don tish mi trut wey dem learn from dia papa;
15:19 doz wey God give di land before any strenja kon stay with dem.
15:20 Wiked pipol go sofa ponishment as long as dem dey dis eart. Na pains go full dia years for dis world.
15:21 Vois wey dey make pesin fear nor go leave dia ear and where dem feel sey dem dey save, tif go kom meet dem for der.
15:22 Dem nor get hope to kom out from darkness, bikos swod dey wait to kill dem trowey.
15:23 Dem dey waka anyhow dey find food. Dem know sey di day wey God go distroy dem don near.
15:24 Just like wen strong king dey wait to attack en enemies, na so too fear and pain dey make dem shake,
15:25 bikos dem dey tok to God anyhow, dey make mout for di Oga wey dey mighty.
15:26 Dem hold dia strong swod dey won fight di Oga God.
15:27 Dis wiked pipol big and dem dey prosper; dia waist fat well-well too.
15:28 But dia towns go skata. Dem go stay for abandon house wey don near skata.
15:29 Dia money nor go tey for dia hand and nor-tin wey dem get, go last. Even dia propaty go finish.
15:30 Dem nor go fit run from darkness; dem go bi like tree wey en branches don burn finish and dem go skata as God breath.
15:31 If dem nor get sense rish and dem kon dey bilive bad tins, na di bad tins go follow dem.
15:32 Dem go die finish before dia time go rish den dia branches nor go ever green again for life.
15:33 Dem go bi like tree wey dem kwik plok en fruits; like olive tree wey lost en beauti.
15:34 Doz wey nor dey fear God nor go get anytin at-all and na fire go burn di house wey dem build with wayo money.
15:35 Dis na di pipol wey plan trobol and born wikedness. Na lie full dia belle.”