Library · pcm

Job 16

16:1 Job ansa: 16:2 “I don hear many words like dis before. Yor konfort na more trobol for mi! 16:3 All dis yeye word wey yu dey tok neva taya yu? Wetin make yu still dey ansa mi? 16:4 If na yu dey face wetin I dey face so; true-true, I go tok di same tin wey yu dey tok. I go shake my head kon tok against yu. 16:5 But fit to sey na mi I for enkourage yu. I go try reduce yor pains. 16:6 “But e nor get wetin I go tok give yu, wey fit help mi and even if I kwayet, e nor go remove my pains. 16:7 My Oga God, true-true, Yu don kill my full family and Yu don make life taya mi. 16:8 Yu don seize and turn mi to yor enemy. Na skin and bone I bi and pipol dey use am against mi. 16:9 God don skata mi, bikos E dey vex. E tear mi with en tit and dey look mi one kind. 16:10 Pipol dey curse and laf mi. Dem dey slap mi for face and dem don gada against mi. 16:11 God don karry mi give wiked pipol. E don put mi for evil men hand. 16:12 I dey live for peace before, but God don skata mi. E seize mi for my neck kon skata my life. E dey plan against mi. 16:13 E dey shot mi with en arrow from difren direcshon. E nor sorry for mi wen E dey wound mi and na my blood wet di groun. 16:14 E wound mi many times. E attack mi like soja wey hate pesin. 16:15 I dey mourn with sak klot and I use san take kover my face. 16:16 I kry sotey my eyes don dey red and swell-up and naw, na only darkness I dey si. 16:17 I dey pray to God from my heart, bikos I know sey I nor do any bad tin. 16:18 “Dis groun, na beg I dey beg yu, make yu nor kover di bad tins wey dey happen to mi; nor kwayet naw wen I dey kry for help! 16:19 I know sey pesin dey for heaven wey go stand fight for mi. 16:20 My friends dey tok against mi and I dey kry give God. 16:21 Abeg, I nid pesin wey go help mi beg God, just as pesin dey beg en friend. 16:22 My years nor plenty again and I go soon go where I nor go fit kom back again.