Library · pcm

Job 17

17:1 “My spirit don weak well-well and my life go end just naw. Na grave dey wait mi naw. 17:2 Na pipol wey dey laf mi dey round mi; e dey pain mi as I dey look how dem dey wiked mi. 17:3 God, make Yu show sey I dey innocent, bikos nobody gri bilive or fight for mi. 17:4 Yu don klose dia mind, dem nor go fit undastand anytin, but make Yu nor let dem win mi. 17:5 Pesin wey sell en friend bikos of money, na en shidren go sofa am. 17:6 Naw, God don make pipol dey laf mi; dem dey kom spit for my face. 17:7 My eyes don swell-up bikos of kry; my body don tin like broom. 17:8 Good pipol dey shok wen dem si mi. Doz wey dey innocent go tok against doz wey nor dey fear God. 17:9 But doz wey get good heart, dey do wetin dey rite and di ones wey get klean hand, dey strong evriday. 17:10 “But if all of dem kom follow mi stand, I nor go even si one wey wise. 17:11 My plans don fail; my days go soon end and I nor get hope again. 17:12 But my friends don turn nite to day; dem sey lite don near, but na darkness I dey si. 17:13 My only hope na where dead body dey, where I go for go sleep for darkness. 17:14 If I sey, ‘Grave na my papa’ and di worm wey dey chop mi, ‘Na my mama and sistas,’ 17:15 any hope go still dey for mi? Who dey bilive sey I still get hope? 17:16 No, my hope go follow mi wen I dey go where dead body dey? Wi go-go grave togeda?”