Job 18
18:1 Bildad wey kom from shuh kon sey:
18:2 “Job, wen yu go stop to dey tok? If yu stop, wi go tok to yu.
18:3 Wetin make yu dey feel sey wi nor get sense like animals?
18:4 Yu just dey kill yorsef with vexnashon. Make di eart skata, bikos yu dey vex? Abi make mountins shake komot where e dey?
18:5 Wiked pipol lite go soon off; dia fire nor go ever burn again.
18:6 Di lite for dia house go dark; di lantan wey dey dia room go off.
18:7 Dem dey waka well before, but naw, dem go dey stagga; na dia own advise go distroy dem.
18:8 Wiked pipol go waka enter net and e go katch dia leg.
18:9 Trap go katch dia leg kon hold dem for der.
18:10 Dem hide rope for dem for groun kon set trap for where dem go waka pass.
18:11 Fear dey wait dem for evriwhere and e go follow dem as dem dey waka.
18:12 Sofa dey hongry dem; wahala dey wait for dem to fall.
18:13 Sickness don chop dia body finish and na dis make dia hands and legs dey rotin.
18:14 Dem don skata di house where dem for dey save and naw, na di king wey dey make pesin fear, go judge dem.
18:15 Fire go burn wiked pipol house. Yes fire with sulfur don skata dia house rish groun?
18:16 Dia rut don dry finish and dia branches go skata.
18:17 Pipol nor go remember dem for dia house or for outside again, bikos dia name don fade komot from di land.
18:18 Dem go porshu dem from where pipol stay kon still porshu dem from lite enter darkness.
18:19 Dem nor get shidren, grand-shidren or pesin wey go live afta dem don die.
18:20 From east go west, evribody wey hear wetin happen to dem, go fear kon sey,
18:21 ‘True-true, na so wiked pipol house dey bi and pipol wey nor know God, na dem dey stay dis kind place.’ ”