Library · pcm

Job 19

19:1 Job ansa: 19:2 “Bildad, na wen yu go stop to ponish and worry mi with yor words? 19:3 Yu don already curse mi rish ten times. Yu suppose to dey shame as yu dey trit mi like dis. 19:4 Even if I do bad tin, how dat one take koncern yu? 19:5 If yu feel sey yu betta pass mi kon dey use my trobol against mi, 19:6 den make yu know sey na God handwork bi dis, bikos na-im set trap wey katch mi so. 19:7 “If I kry out bikos of dis trobol sef, nobody go ansa mi. I dey kry for help, but nobody dey hear am. 19:8 God don block my way and I nor fit pass; E don hide my way for darkness. 19:9 E don take all my glory kon distroy my respet. 19:10 E skata mi for evry side, until I nor get hope again. 19:11 God dey vex for mi, so E kount mi join en enemies. 19:12 En sojas kom attack mi; dem skata my life kon build dia kamp round my house. 19:13 “God don make my family far from mi; I don turn strenja to pipol wey know mi. 19:14 My family don go leave mi. My friends don forget mi. 19:15 Even di strenjas for my house don forget mi and my wimen savant dey do like sey na mi bi strenja. 19:16 Wen I koll my savant, e nor gri ansa, even wen I beg am with my own mout. 19:17 My wife nor fit stay where I dey breath and my own broda nor gri kom near mi. 19:18 Shidren sef dey laf wen dem si mi. Wen I won tok, dem go turn waka leave mi. 19:19 My klose friends dey look mi with shame and di ones wey I love, don turn against mi. 19:20 My bones just whole my skin and I just manage dey run with my life. 19:21 Una wey bi my friends! Make una sorry for mi naw, bikos God don nak mi fall with en hand. 19:22 Why yu dey porshu mi, just as God dey porshu mi? Abi yu neva trobol mi rish? 19:23 “I for like sey somebody go remember all wetin I dey tok, make e for rite dem for book! 19:24 Or make e karve and rite di words for stone, so dat dem go dey forever. 19:25 But I know sey God dey for heaven and E go kom save mi for di end. 19:26 Even wen sickness don chop my skin, as I still dey dis body, I go si God. 19:27 I go si am with my eye and E nor go bi anoda pesin at-all. 19:28 So wetin make yu dey akuiz mi dey sey, ‘Na yu kause di wahala wey yu dey face?’ 19:29 But fear di swod naw; dat swod wey dey bring God ponishment. So make yu know sey e get pesin wey go judge my kase.”