Library · pcm

Job 20

20:1 Zofar still sey: 20:2 “Job! Yu dey make mi vex. Naw, I nor fit wait before I ansa. 20:3 All di tins wey yu dey tok since, na curse! But I know wetin to tell yu. 20:4 Yu know sey wen God first kreate human being, 20:5 wikedness nor dey and di joy wen pesin wey nor dey fear God get, nor dey last. 20:6 Dem fit big well-well, dey great and dia head dey tosh heaven, 20:7 but God go blow all of dem trowey like dust. Pipol wey know dem before go sopraiz kon ask, ‘Where dem go?’ 20:8 Dem go vanish like dream and vishon for nite and pipol nor go si dem again. 20:9 Pipol wey si dem before, nor go si dem again. Dia family nor go si dem again 20:10 and dia shidren go beg poor pipol; dem go pay back all wetin dia papa tif from poor pipol hand. 20:11 Dia smooth and betta body, go soon turn to dust. 20:12 Bikos bad tins sweet, dem kon keep some for dia mout 20:13 and bikos dem won enjoy di sweetness, dem nor gri komot am from dia mout. 20:14 But di food go betta like poizin for dia belle. E go bi like snake poizin inside dia body. 20:15 Wiked pipol go vomit di money wey dem tif. God go take am back with di ones wey dey dia belle. 20:16 Wetin wiked pipol swallow bi like poizin; e dey kill dem like who wiked snake bite. 20:17 Dem nor go live to si di river wey get olive or di one wey milk and honey full. 20:18 Dem must die leave evritin wey dem work for; dem nor go get shance to chop from dia money, 20:19 bikos dem don beat and kollect from pipol wey nor get. Dem still seize dia house, 20:20 bikos nor-tin dey rish dem, but wetin dem get nor go fit save dem. 20:21 Nor-tin dey remain for plate wey dem take chop; dat na why dia propaty nor dey last. 20:22 Wen dia propaty don dey plenty, trobol go kom skata and distroy am. 20:23 Make God feed dem beleful with trobol. Make God pour in vexnashon for dia head like evening rain dey fall. 20:24 Wen dem won run, bikos of iron swod, di bronze bow go shot dem fall. 20:25 As dem pul di arrow komot dia body, blood go rush kom out and fear go kill dem trowey. 20:26 Evritin wey dem don save, go skata. Fire wey pesin nor lite, na-im go kom burn dem die with dia family. 20:27 Heaven nor go kover dia sins and di eart go tok against dem. 20:28 Evritin wey dem get, God go distroy am with wota wen E dey vex. 20:29 Dis na wetin go happen to wiked pipol! Dis na wetin God go do dem.”