Job 21
21:1 Job ansa:
21:2 “Make yu listin to wetin I dey tok. Dis na all di konfort wey I ask from yu.
21:3 Give mi shance make I tok and if I tok finish, yu fit laf mi, if yu like.
21:4 I dey komplain give human being? If I nor dey komplain give human being, wetin go make mi kwayet?
21:5 Di way yu dey si mi naw dey sopraiz yu! Make yu shok put yor hand for mout.
21:6 Wen I tink about wetin dey happen to mi, my body go dey shake, bikos of fear.
21:7 “Why God dey let wiked pipol live? Why E dey make dem old kon prosper?
21:8 Dem get shidren and grand-grand shidren and dem dey si as dia shidren dey grow.
21:9 God nor dey send trobol go skata dia house; dem nor dey live with fear.
21:10 All dia kattle dey get belle and born without trobol or wahala.
21:11 Dia shidren dey run and play like animal pikin wey nor get problem.
21:12 Dem dey dance, dey play sheke-sheke, harp and dey enjoy dia trumpet sound.
21:13 Dem dey live dia life for peace and dey die without trobol.
21:14 Dem dey tell God sey ‘Leave us! Wi nor won serve or follow Yu.’
21:15 Dem sey ‘Who bi dis God sef? Why wi go serve am? Any gain dey to pray to am?’
21:16 Dem tink sey na dia pawa dem take get evritin wey dem get, but I nor agri with wetin dem dey tink.
21:17 “Dem don ever kwensh di lite wey wiked pipol get? Wiked pipol don ever face trobol? God don ever vex ponish wiked pipol?
21:18 How many times dem bi like leaf wey breeze blow trowey or dust wey breeze karry go?
21:19 Yu dey sey, ‘God go ponish pikin for di sin wey en papa kommit!’ No! But make God ponish di pesin wey sin, so dat e go know wetin e do!
21:20 Make who sin karry di trobol by ensef; make dem feel God vexnashon.
21:21 Bikos wen pesin die, e nor kare about wetin happen to en family.
21:22 Anybody fit tish God, abi who dey judge doz wey dey heaven?
21:23 “Some pipol nor sick at-all until di day wen dem die; dem die with happiness and dem dey for peace.
21:24 Dia body dey shine well-well and dia bones dey strong.
21:25 Odas nor get happiness at-all; dem live and die with bitterness for dia mind.
21:26 But evribody must die. Dem dey beri who don die and worm dey kover di body.
21:27 “Yes! I know wetin yu dey tink. Yu dey tink how yu go take wound mi
21:28 Yu go soon tell mi about rish and wiked pipol wey dia house don vanish bikos of sin.
21:29 Abi yu neva tok to pipol wey travel before? Yu nor know di kind ripot wey dem dey bring kom back?
21:30 Di day wey God go vex ponish pipol, na di wiked ones E go sorry for.
21:31 E nor get who fit blame wiked pipol for all wetin dem don do.
21:32 Dem go guide di grave wey dem beri dem put afta dem don die.
21:33 Pipol go many for dia burial and di san go kold for dia body.
21:34 So how yor bad words won take konfort mi wey e bi sey evry ansa wey yu dey give mi, na lie!”