Library · pcm

Job 22

22:1 Elifaz wey kom from Teman still sey: 22:2 “E get any wise pesin wey God fit gain from? 22:3 Yu feel sey God get gain from di good tins wey yu dey do or di rite way wey yu dey follow? 22:4 God dey ponish yu, bikos yu too obey and respet am? 22:5 No! Na bikos of yor sin and all di oda bad tins wey yu do. 22:6 Yu sey make yor broda pay di money wey e dey hold yu kon seize all en klot. 22:7 Pipol wey don taya to work, yu nor agri give dem wota drink and wen dem dey hongry, yu nor give dem food chop. 22:8 Yu dey opress pipol with yor pawa and pozishon. 22:9 Nor bi only sey yu nor gri help wimen wey nor get husband again, but yu dey ponish and kollect from shidren wey dia papa and mama don die. 22:10 Naw, si as trobol surround yu and fear don dey kill yu small-small. 22:11 Yu nor dey si again, bikos di trobol don too dark for yor eye and wota don kover yu. 22:12 God too dey big! E high pass di heavens and from der E dey look di stars as dem high rish. 22:13 But yu still ask, ‘Wetin God know? How E won take judge us thru dis tick darkness?’ 22:14 Yu feel sey as di kloud tick rish, God nor go si as E dey waka for heaven? 22:15 Yu really won waka for di road wey wiked pipol dey pass? 22:16 Even before dia time end, wota don karry dem go. 22:17 Dis na di pipol wey rijet God, dem bilive sey E nor fit do dem anytin. 22:18 Na dis God make dem get money, yet I nor fit undastand how wiked pipol dey tink sef. 22:19 Good pipol dey happy and doz wey dia belle klean, dey laf. 22:20 Evritin wey wiked pipol get don skata and fire don burn di ones wey remain. 22:21 Job! Abeg, go setol with God. Nor dey bihave like sey God na yor enemy. If yu follow am make peace, E go bless yu. 22:22 Make yu follow di tins wey E dey tish kon keep en words for yor heart. 22:23 Make yu go back go meet God; if yu remove wiked tins for yor house, E go karry yu up. 22:24 If yu stop to porshu money kon trowey yor gold for river, 22:25 God wey dey heaven go bi yor propaty. E go bi yor gold and silva. 22:26 Den yu go bilive God kon know sey na-im dey give happiness. 22:27 Wen yu pray, E go ansa yu and yu go keep di promise wey yu don make. 22:28 Yu go prosper for evritin wey yu dey do and lite go shine for yor way. 22:29 God dey save pipol wey dey honbol, but doz wey feel sey dem wise, E dey disgrace dem. 22:30 God go save pesin wey nor dey innocent, bikos yor hand dey klean.”