Library · pcm

Job 33

33:1 “Job, make yu listin and hear evritin wey I won tok! 33:2 Si naw, I don open my mout and my tongue won start to tok. 33:3 All my words na true and na true I go tok. 33:4 Na God Spirit make mi and na en breath give mi life. 33:5 Make yu ansa mi if yu fit. Make yu dey ready and prepare yor kweshons. 33:6 Na di same tin mi and yu bi for God eye, na san dem take make mi and yu. 33:7 So yu nor get rizin to fear mi and I nor go wahala yu too mush. 33:8 “Naw, dis na wetin I hear wen yu dey tok: 33:9 ‘I nor dey guilty; I neva do any bad tin or kommit sin. 33:10 But God dey find rizin make E for dey ponish mi like sey I bi en enemy. 33:11 E tie my leg with shain; E dey si evriwhere wey I waka go.’ 33:12 But I won tell yu sey yu dey wrong, bikos God big pass evribody. 33:13 Why yu dey akuiz God sey E nor dey ever ansa yor komplain? 33:14 “Even as God dey tok evritime, nobody won wait listin to wetin E dey tok. 33:15 For nite wey pipol dey sleep, God dey tok to dem for vishon or thru dreams. 33:16 Wen E make dem listin to wetin E dey tok, dem go dey fear for di warnin wey E dey give dem. 33:17 God dey tok so dat dem go stop to sin kon honbol demsef, make E for fit save dem. 33:18 E nor go let dem distroy demsef; E go save dem from deat. 33:19 God dey send sickness to take korrect some pipol and dem go take korreshon wen dia body dey feel di pain. 33:20 Pipol wey dey sick nor fit even chop di food wey sweet well-well. 33:21 Dia body dey die go and yu nor go fit si dia bones again. 33:22 Dem go soon go join dead body. Deat angel dey wait for dem. 33:23 May bi one angel go help am; one out of di tazon angels wey God get wey go tell am wetin dey rite. 33:24 Bikos God don forgi-am, di angel go sey, ‘Release am! E nor go fit go join dead body. Si wetin dem take replace en sin, so e don dey free.’ 33:25 En body go kom yong and strong again like small pikin own. 33:26 Den wen e pray, God go ansa am. E go woship God with happiness. God go make am dey raitious for en eye again. 33:27 Di pesin go sing give odas sey, ‘I sin kon do wetin dey bad, but God nor ponish mi as e suppose to bi.’ 33:28 E don save mi from deat and I still dey alive. 33:29 “True-true, God dey always do like dis, many-many times with pipol. 33:30 E dey save pesin life from deat and make am enjoy life again. 33:31 So Job, make yu listin to wetin I dey tok. Naw, kwayet make yu let mi tok. 33:32 But if yu get wetin yu won tok, tok and I go tell yu if yu dey rite. 33:33 But if yu nor get, make yu kwayet listin to mi and I go tish yu wisdom.”