Library · pcm

Job 34

34:1 Elihu still sey: 34:2 “Wise men, make una listin to my words; Make una hear mi, men wey know well-well. 34:3 Una know betta food wen una put am for mout, but una ear nor know wise word wen e hear am. 34:4 So make wi choose wetin dey rite. Make wi know among awasef wetin dey good. 34:5 Job sey en know do bad tin and God nor gri defend am. 34:6 E sey, ‘As I dey rite so, make I lie sey I dey wrong? Dem nor fit heal my wound, even doh I nor sin at-all.’ 34:7 Yu don si any man wey bi like Job wey dey tok anyhow? 34:8 E like make bad pipol dey stay with am and e dey waka with sinnas. 34:9 E sey pesin nor dey gain anytin, if e dey obey God. 34:10 “Men wey dey undastand, make una listin to mi! God Almighty go fit do wetin dey wrong? 34:11 E dey reward pipol for wetin dem do and dey trit dem as dem deserve. 34:12 True-true, God nor dey do bad tin; E dey judge evribody as e suppose bi. 34:13 Abi God get en pawa for anoda place? Na somebody tell am sey make E kare for di world? 34:14 If God remove di breath wey dey give us life, 34:15 den evribody wey dey live for dis life go die kon turn to san. 34:16 “Naw, make yu listin to mi. If yu get undastandin, make yu hear mi. 34:17 So yu dey tok sey God nor dey rite naw? Yu feel sey E hate justice? 34:18 God dey kondemn kings and rulers wey wiked and nor dey yuzful. 34:19 E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem. 34:20 Pesin fit die for nite just like dat, but God nor dey struggol to distroy pipol wey tink sey dem get pawa. 34:21 God dey si evritin wey wi dey do. E dey si evry step wey wi take. 34:22 E nor get as di darkness tick rish, e nor fit hide sinnas from God. 34:23 Wi nor fit set di time wey God go take judge all of us. 34:24 E nor nid pesin to tell am anytin, before E go remove leader kon put anoda pesin for en post. 34:25 Bikos E know wetin di leader do. E fit ova-trow and skata dem for nite. 34:26 E dey ponish sinnas bikos of dia sin and na for where evribody go for si dem, 34:27 bikos dem don stop to follow en laws and kommand. 34:28 Dem make poor pipol dey kry to God and E don hear dia koll for help. 34:29 If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry. 34:30 God dey do like dis, so dat wiked pipol nor go rule and opress di pipol. 34:31 “Wetin make pipol nor dey konfess dia sins give God kon promise sey dem nor go sin again; 34:32 den tell mi my fault so dat I nor go do dem again? 34:33 Job! Na yor choice, nor bi mi go tell God wetin yu wont, bikos yu don rijet all dis tin. Naw, make yu tell us wetin yu dey tink. 34:34 True-true, anybody wey get sense go gri and if wise man hear mi, e go tok sey, 34:35 Job just dey tok, bikos e nor know wetin e dey tok and all wetin e dey tok, nor make sense. 34:36 But I wish sey dem test Job rish di end, bikos e dey ansa like wiked pesin. 34:37 E don add trobol join e sins, bikos for awa front, e dey klap en hand and dey akuiz God.”