Library · pcm

Job 35

35:1 Elihu still sey: 35:2 “Job, e dey rite make yu dey sey yu nor do any bad tin for God eye? 35:3 Or to ask God sey, ‘Wetin I go gain if I nor sin? Any nid dey to live klean life?’ 35:4 I go ansa yu and all yor friends. 35:5 Make una si how di kloud high rish! Make una look di sky well-well! 35:6 If yu sin, e nor give God any trobol. Even if yu kontinue to dey sin, e nor go shake am. 35:7 Even if yu dey good well-well, na God yu dey favor? E nor get wetin God wont for yor hand. 35:8 Just as yor wikedness dey affect only pipol wey dey do like yu, na so too di good wey yu do, go affect doz wey dey do good. 35:9 Bikos of di opreshon wey pipol dey sofa from strong pipol, dem dey kry for help. 35:10 But dem nor dey kry to God wey kreate dem; wey dey give dem hope for darkness. 35:11 Dem nor dey turn to God wey make us get sense; di One wey make us wise pass animals and birds. 35:12 Dem dey kry for help, but God nor dey ansa dem, bikos dem too proud and dem dey do bad tins. 35:13 E nor get nid for dem to kry; bikos God nor dey si or hear dia kry. 35:14 Yu sey yu nor fit si God; but make yu dey patient, bikos yor matter dey en hand. 35:15 Yu sey, ‘Wen God vex, E nor dey ponish pipol, bikos E nor dey kare about di bad tins wey dem dey do.’ 35:16 But Job! No nid for yu to dey tok, bikos e klear sey yu nor know wetin yu dey tok about.”