Library · pcm

Job 5

5:1 “Job, make yu koll naw, if anybody go ansa yu? Na who dey holy wey yu won go meet? 5:2 Na vexnashon dey kill who nor get sense and na jealousy dey kill fool. 5:3 I don si sey fool fit dey progress, but na wons wahala go kom distroy evritin wey e get. 5:4 Dia shidren nor dey save; no lawyer dey to defend dem for kourt. 5:5 Doz wey dey hongry go chop wetin di fool dem plant; grass go grow kover wetin dem plant. Pipol wey get long-trot, go tif dia propaty. 5:6 Evil nor dey grow from dust or trobol from groun. 5:7 But just as lite dey shine go up, na so too dem born pesin enter trobol. 5:8 “But if na mi, I go look for God kon komplain gi-am. 5:9 Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end. 5:10 E dey give rain to di eart and wota for di san. 5:11 Na God dey karry doz wey dey honbol go up and give joy to doz wey dey mourn. 5:12 E skata and make sure sey wayo pipol nor fit do wetin dem plan! 5:13 E dey katch pipol wey feel sey na dem get sense pass kon end dia wayo work. 5:14 Dem dey waka for darkness for day time. For aftanoon, dem dey waka dey find road like sey dem dey darkness. 5:15 But na God dey save poor pipol from deat. E dey save doz wey nor get, from doz wey get pawa. 5:16 E dey give hope to di poor kon silent wiked pipol. 5:17 Na blessing dey follow di man wey God korrect! So make yu nor komplain wen God dey ponish yu for yor sins. 5:18 God go kover where E for wound yu; na en hand wound yu and na dat same hand E go take heal yu. 5:19 E go save yu from trobol six times and wen e rish di sevent one, evil pipol nor go fit tosh yu. 5:20 Wen honga kom, E go keep yu alive; wen war kom, E go protet yu, so dat yu nor go die. 5:21 God go diliver yu from trobol; E go save yu wen distroshon kom. 5:22 Yu go laf trobol and honga; yu nor go fear wiked animals again. 5:23 Di land wey yu klear go dey free from stones and wild animals nor go kom near am. 5:24 Peace go dey yor house and wen yu look yor propaty, evritin go komplete. 5:25 Yu go get many shidren! Dem go plenty like grass for dis eart. 5:26 Just as rice dey wait until den won harvest am, na so too yu go old before yu die. 5:27 Job, wi don study dis tin wey dey happen and wi know sey na true. So, hear dis words make yu use am for yor own good.”