Job 6
6:1 Den Job ansa:
6:2 “If dem put my trobol and pains for skale,
6:3 dem go heavy pass san wey dey for sea, bikos dem dey heavy and na dis make knee dey tok like dis.
6:4 God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.
6:5 Donkey dey fear wen e dey chop grass? Abi melu dey kwayet wen e dey near food?
6:6 But who fit chop food wey nor get salt or taste? Or wish kind taste dey for di white part for egg?
6:7 I nor fit tosh dat kind food, bikos e dey make mi sick.
6:8 “Why God nor gri give mi wetin I ask for? Why E nor ansa my prayer?
6:9 I wish sey God go distroy mi! I wish sey E go just kill mi with en hand.
6:10 Aldo I get mind with dis sey: Even with all di pains wey I get, I neva ever go against God word.
6:11 Wish kind pawa I get to still dey alive? Why I still dey live wen I nor get hope?
6:12 Na stone dem take make my strent? Abi my body na bronze?
6:13 I nor get strent to take help mysef and all my pawa don komot from my body.
6:14 “Pesin wey dey face dis kind trobol, e suppose get betta friends; weda e forget God or not.
6:15 But my friends, una don show sey una bi like wota wey dry bikos rain nor fall!
6:16 Di wota dark bikos ice-blok and snow don kover dem.
6:17 But wen hot weda kom, di wota go disappear. Wons heat dey, di wota go vanish from where dem dey.
6:18 Animals wey dey pul karavan waka lost, bikos dem dey find wota and dem waka die for dry land.
6:19 Animals wey dey pul karavan wey kom from Sheba and Tema nor find dem,
6:20 but all dia hope die for dry river.
6:21 To misef, una bi like dat wota; una si fear kon bigin shake.
6:22 “I don ever sey, ‘Make una give mi sometin, or make una give money to pesin for mi?
6:23 Or make una save mi from my enemy pawa and from wiked pipol?’
6:24 “Okay! Make una tish mi; make una tell mi my fault and I go kwayet listin to una.
6:25 True word dey pain o-o! But wetin yu dey tok nor make sense.
6:26 My own word wey bi true nor dey good, but na di yuzles words yu like.
6:27 Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well.
6:28 Make yu look mi for face, I nor go lie give yu.
6:29 Yu don try well-well, stop to tink bad tins Nor kondemn mi again, bikos I dey rite.
6:30 Yu feel sey I dey lie? Yu feel sey I nor know rite from wrong?