Library · pcm

Job 7

7:1 “Evritin wey man dey do for dis life nor bi struggol? Abi awa days nor bi like savant wey dem hire to work? 7:2 Like savant wey dey wait make nite kwik kom; like worker wey dey wait make dem pay am. 7:3 Mont to mont, I nor get anytin to live for; evry nite dey kause pain for mi. 7:4 Wen I sleep, I dey tink dey sey, ‘Wen day go take break?’ I dey waka for nite dey wait make day break. 7:5 Worm don full my body, sickness don kover my body with dirty; my body don skata with sore. 7:6 My days just dey run kwik-kwik like moto; but for di end, I nor get hope. 7:7 My God! Make Yu remember sey my life bi like breeze and my happiness don end. 7:8 Una dey si mi naw with una eyes, but una nor go si mi again. Wen una dey look for mi, I go don go. 7:9 As kloud dey vanish, na so who die nor dey kom back again. 7:10 E nor go ever kom back to en house and nobody go si am again. 7:11 “No! I nor go fit klose my mout; I dey vex for my spirit, so I must tok. I must tok as e dey pain mi for my mind. 7:12 Why Yu put mi for kage make pipol dey look mi? I bi wota juju? 7:13 Make I sey my bed go give mi rest and my pillow go reduce my komplain? 7:14 But Yu still dey make mi fear for dream; yor vishon dey make mi fear well-well. 7:15 E betta make I kill mysef, dan dis kind wiked life wey I dey live. 7:16 I don taya for life; I nor go live forever. Abeg make yu live mi, bikos my life nor good. 7:17 “Wetin bi man wey Yu dey worry for? Why Yu dey borda yorsef with di tin wey Yu kreate? 7:18 Yu dey visit am for morning and evritime, Yu won try or test am. 7:19 Nor look mi again, make Yu leave mi alone, so dat I go swallow my own spit. 7:20 Yu wey dey wosh us, na wetin I do Yu? Abi I don sin against Yu? Why Yu dey target mi? I bi wahala to Yu? 7:21 Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”