Job 8
8:1 Bildad wey kom from Shuah kon sey:
8:2 “Job, wen yu go stop to dey tok like dis, wen e bi sey di word wey dey yor mout bi like strong wind?
8:3 Abi God nor dey like justice? Abi God nor dey do wetin dey rite?
8:4 Yor shidren go don sin against God, naim make am pay dem for dia sin.
8:5 But if yu look up to God kon beg di Oga wey dey mighty;
8:6 if yu klean yorsef kon koll am yor Savior, E go help yu kon give yu back evritin.
8:7 Yor biginnin fit dey small for eye naw, but yor ending go betta well-well.
8:8 Make yu ask generashons wey don pass; tink and follow di trut wey dem sabi;
8:9 bikos dis life wey wi dey so, short well-well. Wi nor know anytin at-all and awa days for dis eart bi like shadow wey go kwik vanish.
8:10 But make yu let doz wey get sense before dem die, tish yu; make yu listin to wetin dem dey tok:
8:11 Papyrus plants fit grow for where river nor dey? Abi reed fit grow without wota?
8:12 If wota dry, na dem go first die wen e neva rish to kut or use dem.
8:13 Pipol wey nor dey fear God bi like di reed; dia hope don go as dem just forget God.
8:14 Dem bilive bad-bad tins and dia sekurity bi like spider house.
8:15 If dem rest for spider house, e go fit hold dem? If dem hold di spider rope, e go fit make dem stand?
8:16 Wiked pipol plenty like betta grass for sun wey dem dey wota, wey skata around di gardin.
8:17 Dem wrap dia rut for plenty stone kon dey look for where dem go hide put for di rock.
8:18 But if dem rut dem komot for dia place, dat place go rijet dem kon sey, ‘I neva si una before!’
8:19 Yes, dat na all di joy wey wiked pipol get and from inside di eart, odas go kom take dia place.
8:20 But God nor go ever help wiked pipol kon let pesin wey dey fear am, sofa.
8:21 E go pak laf full yor mout and yor lip go dey happy.
8:22 But E go disgrace pipol wey hate yu and wiked pipol house go vanish.”