Psalms 90
90:1 My Oga God, from generashon to generashon na Yu dey protet us!
90:2 Yu bi God wey nor dey die! Even before Yu kreate di mountins and di whole world, Yu don dey.
90:3 Yu make human being go back to san where Yu from kreate dem wen Yu sey, “Make una go back to where I for kreate una!”
90:4 To Yu, one tazon years bi like one day or like some hours for nite.
90:5 Yu dey swip pipol trowey like dream wey dey vanish. Dem bi like grass wey grow for morning.
90:6 For morning, dem dey grow and shine, but for evening, dem go dry kon die.
90:7 Yes, yor vexnashon dey kill us and Yu dey make us fear as Yu dey vex.
90:8 Yu know all di sins wey wi kommit; even di sins wey wi hide do, Yu dey si all of dem.
90:9 Yes! As wi dey alive, wi dey si as Yu dey vex and awa years dey kwik-kwik end.
90:10 Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.
90:11 So na who go fit know as Yu dey vex rish? Yor vexnashon strong well-well and e dey make us fear Yu.
90:12 So make Yu tish us, so dat wi go know sey wi bi ordinary human being, den awa wisdom go dey grow more-more.
90:13 My God, make Yu kom back to us! Na how long wi go dey sofa like dis? Make Yu kom sorry for yor savants!
90:14 Make Yu satisfy us evry morning with yor love wey nor dey fail, so dat till wi die, wi go always dey sing with joy.
90:15 Make Yu replace awa former sofa with happiness and awa bad years with good tins!
90:16 Make Yu let wi yor savants si yor works again kon allow awa shidren si yor glory.
90:17 Make di Oga awa God show us en favor, den evritin wey wi dey do, go prosper. Yes! Make Yu allow evritin wey wi dey do, prosper!