Library · pcm

Psalms 91

91:1 Pipol wey dey stay where di Most High God dey, go dey save under en shadow. 91:2 So dis na wetin I tok about God: “Na only en bi di place where I dey hide put, where wiked pipol nor go for fit tosh mi; na-im bi my God and I trust am well-well.” 91:3 Bikos E go save yu from evry trap kon protet yu from doz diziz wey dey kill pesin. 91:4 E go kover yu with en feada and na der yu go dey save. Na en promise wey nor dey fail, dey guide and protet us. 91:5 So, make una nor fear di wahala for nite or di arrow wey dey fly for day time. 91:6 Make una nor fear diziz wey dey kom for darkness or trobol wey dey kom for aftanoon. 91:7 Aldo one tazon pipol go fall for una side and ten tazon dey die around una, but di enemies and dia evil nor go fit tosh una. 91:8 Una go si am with una own eyes! Yes, una go si as God dey ponish wiked pipol. 91:9 If una make God di place where una dey hide put; if una make di Most High God where una dey stay, 91:10 no evil go fit tosh una and no wahala or diziz go kom near where una dey. 91:11 Bikos E go kommand en angels make dem protet una for evritin wey una dey do. 91:12 Dem go use dia hand karry una up, so dat una nor go even kick or fall on-top stone. 91:13 Una go mash lions and kobra pass; una go mash wiked lions and snakes go dey under una leg! 91:14 God sey, “I go save pipol wey love mi. I go protet doz wey trust my name. 91:15 Wen dem koll mi, I go ansa dem; I go dey with dem wen dem dey trobol. I go save and make pipol honor dem. 91:16 I go bless dem with long life and give dem my salvashon.”