Library · pcm

Psalms 92

92:1 E dey good to tank God. Yes! Awa belle dey sweet us wen ever wi dey sing and praiz di Most High God. 92:2 For morning, e dey good to tok about yor love wey nor dey fail and for evening, wi go sing of yor faithfulnes, 92:3 with harp wey get ten rope and jita. 92:4 My God, Yu dey make mi happy bikos of evritin wey Yu do and I go sing praiz Yu, bikos Yu dey good to mi. 92:5 Wi dey si di great work wey Yu do! Di tins wey Yu dey tink, deep well-well. 92:6 Who nor get sense nor go fit know wetin Yu dey do and na only fools nor go undastand sey: 92:7 “Wiked pipol dey grow like grass and doz wey dey do evil dey prosper, but God go distroy dem forever.” 92:8 But Yu, my Oga God, dem go praiz Yu forever. 92:9 Yor enemies go die trowey and all di pipol wey dey do evil, go skata. 92:10 But Yu don make mi strong like melu wey dey bush and use oil wey fine pass, take anoint mi. 92:11 My eyes don si my enemies dey fall and my ear don hear as God win doz wiked pipol. 92:12 But doz wey dey fear God, go prosper like bambo tree and dem go strong as dem dey grow like cedar tree for Lebanon. 92:13 Bikos God don plant dem for en house, dem go grow well. 92:14 Dem go still dey produce fruit for old age! Dem go dey strong and fresh well-well. 92:15 Dem go sey, “God dey judge well! Na-im bi awa Rock and E nor dey do bad tin!”