Psalms 93
93:1 God na king and en glory wey dey shine well-well, kover evriwhere. True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa. Di world stand gidigba and nor-tin fit shake am.
93:2 My God, yor throne don dey even before Yu kreate di world. Yu yorsef, don dey forever and ever.
93:3 My Oga God, even doh rivers dey full and make nois like tonda as dem dey go up-and-down,
93:4 Yu wey dey up, strong pass di waves and river wey dey rush with speed. God get pawa pass all dis tins!
93:5 My God! Nobody fit shange yor laws! Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.