Library · pcm

Proverbs 10

10:1 Dis na di wise words wey Solomon tok: Shidren wey wise dey make dia papa proud, but fools dey kause pain for dia mama. 10:2 Propaty wey yu use wayo take get nor go do yu any good, but trut go save yu. 10:3 God nor go let honga kill good pipol and E nor go allow wiked pipol get wetin dem wont. 10:4 Lazines go make yu poor, but hard work go make yu get money well-well. 10:5 Pesin wey get sense dey plok en fruit for di rite time; but na disgrace for pesin to dey sleep for harvest time. 10:6 Blessing dey follow good pipol, but wiked pipol words dey put dem for trobol. 10:7 Pipol go remember good pesin bikos of di good tins wey e do, but dem go soon forget wiked pesin forever. 10:8 Pipol wey get sense dey happy well-well wen dem advise dem, but foolish pipol words go distroy dem. 10:9 Pipol wey dey tok trut dey save and sikure, but wayo pipol dey waka enter trobol. 10:10 Pesin wey dey hide di trut dey kause trobol, but pesin wey dey tok am for publik, dey work for peace. 10:11 Good pesin word dey give long life, but wiked pesin word dey put am for trobol. 10:12 Na only trobol bad belle dey kause, but love dey kover evry sin. 10:13 If pesin get sense, e dey show wen e dey tok, but if yu dey foolish, na stik dem go take beat yu. 10:14 Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get, but wen yu hear foolish pipol dey tok, yu go know sey trobol nor dey far from dem. 10:15 Money dey protet rish pipol, but poverty dey distroy poor pipol. 10:16 Na life bi di reward to do good, but sin dey put pesin for more trobol. 10:17 Pipol wey dey listin if dem korrect dem go get long life, but doz wey nor dey gri sey dem dey wrong, dey waka lost. 10:18 Anybody wey pritend sey e like pesin, dey lie and anybody wey dey lie waka, na fool. 10:19 Too mush tok dey make pesin sin, but wise pesin nor dey tok anyhow. 10:20 Di words wey betta pesin tok bi like pure silva, but wiked pipol words dey yuzles. 10:21 Many pipol dey gain from word wey betta pesin tok, but stupid word fit kill pesin. 10:22 Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret. 10:23 Foolish pipol dey enjoy di bad tins wey dem dey do, but pipol wey get sense, dey happy to get wisdom. 10:24 Raitious pipol dey get wetin dem wont, but wetin wiked pipol dey get, na di tin wey dem fear pass. 10:25 Wen heavy breeze dey blow, e go blow wiked pipol trowey, but pipol wey dey tok trut, dey always dey save. 10:26 Nor allow lazy pesin work for yu, bikos e go bi like betta wine for yor mout or like smoke wey enter yor eye. 10:27 Obey God and yu go get long life; bikos wiked pipol dey die before dia time. 10:28 Di hope wey good pipol get, dey give dem joy, but wiked pipol, nor get wetin dem dey hope for. 10:29 God dey protet pipol wey dey tok trut, but doz wey dey do bad tins, na distroshon bi dia own. 10:30 Raitious pipol go always dey save, but wiked pipol nor go stay long for dis world. 10:31 Raitious pipol dey tok with sense, but anybody wey dey tok bad tins, go die. 10:32 If yu obey God, yu go always know di rite words to tok. But nobody go trust yu if yu always dey lie.