Library · pcm

Proverbs 11

11:1 God hate pipol wey dey play wayo, but E dey love doz wey dey do good tins. 11:2 E good to dey honest, but na disgrace go follow proud pipol. 11:3 Na trut dey guide yu if yu dey good; but pipol wey dem nor fit trust, na dia own wayo dey distroy dem. 11:4 Wen God won judge yu, yor money and propaty nor go fit help yu, but na to obey God bi di only tin wey go fit save yor life. 11:5 Pesin wey dey good dey always do good tins, but if yu dey do wiked tins, na yor own sin go distroy yu. 11:6 Raitiousness dey save doz wey dey tok trut, but doz wey dem nor fit trust, na dia own bad plans, dey kill dem. 11:7 Wen wiked pipol die, dia hope dey die with dem, bikos dem bilive on dia own pawa. 11:8 Pipol wey dey raitious, God dey protet dem from trobol; but trobol dey always follow wiked pipol. 11:9 Doz wey nor know God, wetin dem dey tok, fit distroy pesin, but di sense wey raitious pipol take dey tok, go save life. 11:10 Just as pipol dey happy wen good pesin dey prosper, na so too dem dey happy wen wiked pesin die. 11:11 E go betta for any town wey raitious pipol bless; but wiked pipol words go distroy am. 11:12 E too tok bad about odas, but if yu get sense, yu go fit kontrol yor mout. 11:13 Pesin wey dey judge anoda pesin, nor go fit keep sekret, but yu fit trust pesin wey dey tok trut. 11:14 Any nashon wey nor get who dey guide am, go fall, but wen doz wey dey give yu good advise many, yu go prosper. 11:15 Trobol dey follow who promise to pay di money wey strenja owe. So, e betta if yu nor put yorsef for di matter at-all. 11:16 Dem dey respet woman wey dey respet pipol, but even with all di propaty wey wiked men get, nobody dey respet dem. 11:17 Pesin wey good dey gain favor for ensef; but wiked pipol dey bring trobol for diasef. 11:18 Wiked pipol nor get gain for anytin, but reward dey for who dey do di korrect tin. 11:19 Anybody wey ready to live rite, go get life; but pesin wey sey na bad tins e like to dey do, go die. 11:20 God hate pipol wey get bad mind, but E love doz wey dey do di rite tin. 11:21 Make yu know sey God go ponish wiked pipol; but na betta judgement go follow raitious pipol. 11:22 Fine woman wey nor get sense, bi like ring wey dem put for pig nose and mout. 11:23 Wetin good pipol wont, dey bring good result; but evribody dey vex if wiked pesin get wetin e wont. 11:24 Wen pipol give out dia money, dem dey get more; but doz wey nor dey give, nor dey get at-all. 11:25 Make yu dey give and yu go prosper; help odas and yu go get help. 11:26 Pipol go curse di pesin wey store en korn dey wait who go buy am for high prize; but dem go praiz doz wey sell am for di normal prize. 11:27 Dem go respet yu if yu get good mind; but if yu dey look for trobol waka, na trobol go follow yu. 11:28 Doz wey trust dia propaty, go fall like wetin harmattan breeze blow; but raitious pipol go prosper well-well, dem go bi like sun wey dey shine. 11:29 Pesin wey bring trobol kom meet en family, nor go get anytin and foolish men go always bi savant to wise pipol. 11:30 Raitious pipol fruit bi like tree wey dey give life, but pesin wey dey prish give odas to turn kom meet God, get sense. 11:31 Doz wey good, dey get dia reward for dis world, but na ponishment go follow pipol wey dey sin and do wiked tins.