Library · pcm

Proverbs 9

9:1 Wisdom don build en house with seven pilas. 9:2 E don kill animals to take do party, mix spice for inside di wine kon put am for di tabol. 9:3 E send en savant go announce on-top di mountin for di town sey: 9:4 “Pipol wey nor know anytin, make una kom inside!” Den e tell doz wey foolish sey, 9:5 “Make una kom chop my food and drink di wine wey I mix. 9:6 Make una komot from where fools dey and una go get life. Make una kom follow wisdom waka.” 9:7 If yu korrect proud pipol, dem go curse yu! Anybody wey try to tok to wiked pipol, dem go still curse am. 9:8 So, nor ever korrect proud pipol, bikos dem go hate yu; but if yu korrect wise pesin, e go respet yu forever. 9:9 Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more. Anytin yu tell raitious pipol go give dem undastandin. 9:10 If yu won get wisdom, yu go first fear God. If yu know di One wey dey holy, den yu don get undastandin. 9:11 Wisdom go add more years to yor age. 9:12 Na yu go gain if yu get wisdom, so even if yu rijet am, na yu go still sofa am. 9:13 Foolishness bi like woman wey nor know anytin at-all, nor get shame at-all and wey dey tok anyhow. 9:14 Di woman go sidan for front of en house or for chair for di side wey high pass for di town 9:15 kon dey koll pipol wey dey waka pass; pipol wey dey mind dia own business sey, 9:16 “Pipol wey nor get sense, make una kom inside!” Den e go tell foolish pipol, 9:17 “Wota wey dem tif dey sweet well-well and bread wey dem tif chop, get betta taste.” 9:18 Doz wey fall for en trap nor know sey, anybody wey enter en house go die and doz wey don already enter don die since.