Proverbs 12
12:1 Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.
12:2 God dey happy with good pipol, but E dey kondemn doz wey dey plan wiked tins.
12:3 Wikedness nor dey pay pesin, but nor-tin dey shake good pipol.
12:4 Good wife dey bring joy and pride to en husband; but wife wey dey bring shame for en husband bi like diziz for en bone.
12:5 Good pipol dey always tink good, but make yu nor ever trust anytin wey wiked pipol tell yu.
12:6 Wiked pipol word dey kill, but raitious pipol word dey save pipol.
12:7 Wiked pipol dey die trowey, but doz wey dey fear God, dey get long life.
12:8 Dem dey praiz pesin wey get sense, but nobody dey respet wiked pesin.
12:9 E betta make yu bi ordinary pesin wey dey work to chop, dan to dey karry body up wen yu nor even get garri to soak.
12:10 Raitious pipol dey kare for dia animals, but wiked pipol dey trit dia own anyhow.
12:11 Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop, but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.
12:12 Pipol wey bi tif dey jealous wetin odas tif, but wetin raitious pipol get, dey rish dem, bikos dem dey work for dia own food.
12:13 Wiked pipol words dey put dem for wahala, but raitious pipol go eskape from trobol.
12:14 Wise word get gain and hard work dey bring reward.
12:15 Foolish pipol dey always tink sey wetin dem dey do dey korrect, but wise pipol dey listin to odas.
12:16 Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
12:17 Good witness dey tok trut, but wiked pipol dey always lie.
12:18 Foolish pipol dey tok anyhow, but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.
12:19 Trut go last forever, but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.
12:20 Pesin wey dey tink so-so bad-bad tins, na wikedness full en heart, but doz wey like peace, get joy for dia life.
12:21 Wahala nor fit kom meet doz wey dey fear God, but na trobol dey always follow wiked pipol.
12:22 God hate pipol wey dey lie, but E like doz wey dey tok trut.
12:23 Wise pipol nor dey karry body up, but foolish pipol dey show dia foolishness.
12:24 Na only doz wey work hard go fit lead odas, but lazy pipol go bi slave.
12:25 If pesin dey worry, e go make am sick, but betta word go make yor body strong again.
12:26 Doz wey dey fear God dey advise dia friends well, but wiked pipol dey lead dem enter wahala.
12:27 Lazy pipol nor even fit kook di animal wey dem katch, but doz wey get sense, dey use evritin wey dem get, well.
12:28 Doz wey dey follow God, go get life and dis way wey dem dey follow, nor dey kause deat.