Library · pcm

Proverbs 13

13:1 Pikin wey get sense dey listin to en papa and mama word, but doz wey dey foolish, nor dey take korreshon. 13:2 Wise word go put betta food for yor tabol, but na only wahala wiked pipol go chop. 13:3 Doz wey dey kontrol dia tongue go get long life, bikos anyhow word dey distroy tins. 13:4 Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper. 13:5 Doz wey dey fear God nor like lie; but na only shame and disgrace wiked pipol dey kause. 13:6 Na God dey guide innocent pipol, but na sin dey kontrol wiked pipol. 13:7 Poor pipol dey bihave like sey dem get money, but doz wey get money dey pritend sey dem poor. 13:8 Rish pipol fit pay anytin for dia life, but nobody dey treaten poor man. 13:9 Doz wey dey fear God, na lite and joy full dia body, but wiked pipol lite go soon kwensh. 13:10 To dey karry body up, dey kause wahala, but doz wey dey take advise, wise well-well. 13:11 Money wey pesin play wayo take get kwik-kwik, dey disappear, but di one from hard work dey last forever. 13:12 Wen wetin pesin hope for nor kwik rish en hand, di heart go sick, but dream wey kom to pass, bi like tree wey dey give life. 13:13 Pipol wey nor dey listin to advise dey ask for trobol, but doz wey dey respet di law, go susid. 13:14 Wise pipol word bi like wota wey dey give life and doz wey asept am, dey run from deat. 13:15 Dem dey respet pesin wey get sense, but sturbon pipol go distroy demsef. 13:16 Wise pipol dey tink before dem do anytin, but foolish pipol nor dey tink and dem dey happy sey dem foolish. 13:17 Na manaja wey nor get sense dey enter trobol, but betta manaja dey bring progress. 13:18 If yu vex sey pipol dey korrect yu, na poverty and disgrace go end yor life; but dem go honor yu, if yu asept korreshon. 13:19 If pesin get wetin e wont, e dey sweet am well-well, but na only fool nor dey gri stop di wiked tins wey e dey do. 13:20 Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu. 13:21 Doz wey dey like to sin, na trobol dey porshu dem, but na blessing, raitious pipol go gain. 13:22 Good pipol dey leave propaty for dia grand-shidren, but na doz wey dey fear God dey take evritin wey wiked pipol die leave. 13:23 Poor pesin farm fit produce many food, but wikedness dey make dem disappear. 13:24 Doz wey nor dey korrect dia shidren, hate dem. But doz wey love dia shidren, dey always korrect dem with love. 13:25 Doz wey dey fear God, go get enough food to chop, but na honga go kill wiked pipol.