Proverbs 14
14:1 Wise woman dey build en house, but foolish woman dey skata en own with en hand.
14:2 Doz wey dey do wetin dey good, dey fear God; but doz wey dey do wiked tins, nor dey fear am at-all.
14:3 Foolish words go make dem flog pesin, but wise pesin words, go save en life.
14:4 If pesin nor get melu wey go work for en farm, food nor go dey for am to chop, but strong melu wey sabi work, go make yor korn plenty.
14:5 Good witness nor dey lie, but na lie-lie, wiked pipol dey tok.
14:6 Pipol wey karry body up dey find wisdom, but dem nor go si am, but undastandin dey eazy for pesin wey get sense.
14:7 Make yu waka leave foolish pesin, if not, yu nor go undastand wen wise pesin dey tok to yu.
14:8 Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.
14:9 Foolish pipol dey laf dia own foolishness, but doz wey dey fear God, dey know and ask for forgivenes.
14:10 As yu dey happy wen good tin happen to yu, na so too e go bi wen pain kom. Nobody go fit share dem with yu.
14:11 Dem go distroy wiked pipol house, but doz wey dey fear God, go prosper.
14:12 Wetin pesin dey do fit dey korrect for en eye, but e dey lead am to en grave.
14:13 Wen pesin dey laf, e go forget en pain, but wen di happiness don end, di pain go kom back.
14:14 Just as doz wey dey judge odas dey get wetin dem deserve; na so too good pipol dey get dia reward.
14:15 Doz wey nor get sense dey bilive evritin wey pipol tell dem! But wise man dey wosh en step.
14:16 Wise pipol get sense and dem dey avoid wahala; but foolish pipol dey waka enter trobol.
14:17 Pipol wey dey vex anyhow dey do foolish tins and pipol hate doz wey dey deceive odas.
14:18 Doz wey nor get sense dey wear foolishness as klot for body; but na wisdom bi wise pipol kap.
14:19 Wiked pipol go bow for good pipol; dem go bow for doz wey dey fear God.
14:20 Poor pipol neighbours hate dem, but rish pipol get many friends.
14:21 Na sin for yu nor to respet yor neighbour, but doz wey dey help poor pipol, na blessing go follow dem.
14:22 If yu plan to do bad, yu go lost; but if yu plan to do good, yu go get love and faithfulnes wey nor dey fail.
14:23 Good work dey bring gain, but yeye word dey kause poverty!
14:24 Money na crown for wise pipol head; but foolish pipol work, dey only produce bad result.
14:25 Good witness dey save pesin life, but wiked witness dey put pesin for trobol.
14:26 Doz wey dey fear God, dey save and God dey guide dia shidren.
14:27 To fear God, na wota wey dey give pesin life and e go help yu run from deat.
14:28 Di king glory na wen en pipol dey plenty more-more; but prince wey nor get savants, nor get anytin.
14:29 Pipol wey get sense, dey kontrol demsef wen dem dey vex; but doz wey dey kwik vex, dey show as dem foolish rish.
14:30 Wen peace dey yor heart, e go give yor body life; but jealousy bi like diziz for pesin bone.
14:31 Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.
14:32 Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.
14:33 Wisdom dey follow pesin wey dey fear God; but yu nor fit si wisdom for where foolish pipol dey.
14:34 Wen pipol dey fear God, dia nashon go dey great, but sin na disgrace to evribody.
14:35 Just as king dey happy for en wise savant, na so too e dey vex for doz wey disgrace am.