Proverbs 15
15:1 Good ansa dey end vexnashon, but yeye words dey kause kworel between pipol.
15:2 Wen wise pipol tok, pipol dey undastand well, but na only yeye words dey kom out from foolish pipol mout.
15:3 God dey wosh evriwhere, E dey wosh both good and wiked pipol.
15:4 Gentol word na tree wey dey give life, but lie-lie tongue dey make di spirit weak.
15:5 Na only fool nor dey listin to en mama and papa word; but anybody wey dey take korreshon, go get sense.
15:6 Pipol wey dey fear God, good tins dey always full dia house, but wetin wiked pipol get, dey bring trobol.
15:7 Na good advise dey kom out from wise pipol mout; but foolish pipol heart nor get anytin to give.
15:8 God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.
15:9 God nor like evritin wey wiked pipol dey do, but E love doz wey dey do good.
15:10 Anybody wey nor gri do wetin dey rite, go sofa well-well and anybody wey nor like korreshon, go die.
15:11 Even Deat and Distroshon nor get sekret for where God dey, tok-less of human being heart!
15:12 Doz wey dey laf pipol nor dey like korreshon, so dem dey run from wise pipol.
15:13 Pipol dey smile wen dem dey happy, but sorrow dey make dia spirit weak.
15:14 Wise pipol dey hongry to learn, but foolish pipol dey enjoy wetin dem tink sey dem know.
15:15 Pipol wey get heavy heart, get plenty trobol; but pipol wey dey happy, dey always celebrate.
15:16 E betta to get small propaty and still dey fear God, dan to get evritin with many-many wahala.
15:17 E betta to chop vegitabol with pipol wey yu love, dan to chop meat with pipol wey go fit kill yu.
15:18 Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight; but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.
15:19 If yu dey lazy, tins nor go eazy for yu, but if yu dey do wetin dey rite, trobol go dey far from yu.
15:20 Shidren wey get sense dey always bring joy to dia papa; but foolish shidren nor dey respet dia mama.
15:21 Foolishness dey make doz wey nor get sense happy; but pesin wey get sense, dey always do di rite tin.
15:22 Plans dey spoil wen good advise nor dey; but many advise dey bring progress.
15:23 Evribody dey like good ansa, but e dey good to tok di rite tin for di rite time!
15:24 Wise pipol dey waka for di road wey dey lead to life and nor bi di one wey go take dem go grave.
15:25 God dey skata proud pipol house, but wimen wey dia husband don die, God dey protet dia propaty.
15:26 God hate evil plans, but E like betta words.
15:27 Long-trot dey kill pesin family finish, but doz wey hate bribe, go get long life.
15:28 Doz wey dey fear God, dey tink before dem tok; but na only evil words full wiked pipol mout.
15:29 God dey far from wiked pipol, but E dey hear raitious pipol prayer.
15:30 Happiness dey bring joy to pesin heart and good news dey make pesin happy.
15:31 If yu listin well wen pipol dey korrect yu, yu go dey wise and get sense.
15:32 If yu nor like korreshon, na yorsef yu dey do; but if yu listin to korreshon, yu go always dey undastand.
15:33 To fear God, dey bring wisdom and to honbol yorsef, dey bring honor.