Proverbs 16
16:1 Even doh wi fit make awa own plans, na God get di final sey.
16:2 Yu fit tink sey yu dey always do di rite tin, but na God know wetin dey rite to do.
16:3 If yu tell God make E bless evritin wey yu plan to do, yu go susid.
16:4 Evritin wey God kreate get en purpose; but na wahala, wiked pipol go get.
16:5 God hate pipol wey dey karry body up; E nor go let dem eskape en ponishment.
16:6 If pesin dey honbol and faithful, God go forgi-am en sins. If yu dey fear God, yu nor go gri do bad tins.
16:7 Wen pesin make belle sweet God, even en enemies go like bi en friend.
16:8 E betta to dey honest even doh yu nor get plenty money, dan to use wayo get plenty propaty.
16:9 Pesin fit make en own plan, but na God dey direct anytin wey e go do.
16:10 Di king dey tok with authority wey God gi-am, so make e make sure sey e dey judge well.
16:11 Make una nor dey play wayo wen una dey measure and sell tins give pipol, bikos God nor like am.
16:12 Make kings nor like wiked tins, bikos na korrect judgement dey make govment strong.
16:13 Kings dey always won hear di trut and e go favor doz wey dey tok am.
16:14 Wise pesin go try make belle dey always sweet di king, bikos if di king vex, somebody fit die put.
16:15 Wen di king favor pesin, e dey give life; e bi like kloud wey dey bring rain for en sizin.
16:16 E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.
16:17 Doz wey good nor dey travel pass bad road; so look where yu dey go, bikos e fit save or distroy yor life.
16:18 Pride dey bring distroshon and sturbones fit kill pesin.
16:19 E betta make yu dey honbol and poor, dan to join pipol wey dey karry body up kon follow dem share di propaty wey dem tif.
16:20 Listin to wetin dem tish yu and yu go dey susesful; make yu trust God, so dat blessing go follow yu.
16:21 Yu go no pesin wey wise and dey mature bikos of di undastandin wey e get. As en word sweet rish, na so too e dey give pipol hope.
16:22 Wisdom bi like wota wey dey give life to wise pipol, but na waste of time to go tish foolish pesin.
16:23 Wise pesin dey tink well before e dey tok; so wetin e tok dey give pipol hope.
16:24 Good words bi like honey; e dey sweet di soul kon make body strong.
16:25 Wetin pesin dey do, fit dey good for en eye, but na deat dey end am.
16:26 Pesin wey wont sometin dey work well for am, bikos e nid am.
16:27 Wiked pipol dey always look for how to wound odas; even wetin dem dey tok fit burn and kill pesin like fire.
16:28 Wiked pipol dey do aproko waka; dem dey kause trobol and break friendship.
16:29 Pipol wey dey kause wahala dey deceive dia friends enter trobol.
16:30 Make yu dey kareful with doz wey dey look yu with bad eye, bikos dem don already dey tink bad tin about yu.
16:31 Na long life bi raitious pipol reward and to get white hair, na betta crown.
16:32 E betta to dey patient dan to bi strong warrior. E betta make yu kontrol yorsef dan to kontrol di whole town.
16:33 Wi dey plan as wi wont make tins bi, but na only God dey choose wetin go happen.