Library · pcm

Proverbs 3

3:1 My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do. 3:2 Wetin I tish yu go make yu prosper and get long life. 3:3 So make yu always get faith and dey honbol; tie trut and mesi round yor neck kon rite dem for yor heart. 3:4 If yu do like dat, both God and human being go dey happy and favor yu. 3:5 Make yu always dey trust God with all yor heart, but nor trust wetin yu tink sey yu know. 3:6 Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way. 3:7 Nor tink sey yu wise pass di way yu bi, but just obey God and nor do bad tins. 3:8 If yu do like dis, yor body go dey okay and yor bones go strong well-well. 3:9 Honor God with yor money kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am. 3:10 If yu do so, korn go full yor store and yu go get plenty wine to keep. 3:11 My pikin, if God korrect yu, listin well and take am as warnin. 3:12 Bikos God dey korrect only di pipol wey E love, just as papa dey korrect di pikin wey e dey proud of. 3:13 Pesin wey wise and get undastandin, na happiness go bi en own. 3:14 Undastandin get gain pass silva and e betta pass gold. 3:15 Wisdom get value pass gold and e nor get anytin wey yu fit use take kompare am. 3:16 E go give yu long life, plenty propaty and honor. 3:17 E go still make yor life sweet and yu go dey save. 3:18 Wisdom na tree wey dey give life and e dey make pipol wey kom meet am, happy. 3:19 God kreate di eart with en wisdom and na en undastandin E take make di heavens. 3:20 Na en wisdom make river dey flow and na-im dey make kloud bring rain kom di eart. 3:21 So my pikin, whole di wisdom and undastandin wey yu get well and yu nor ever let dem live yu. 3:22 Dem go make yu live sweet and happy life. Dem go bi like betta shain for yor neck. 3:23 Dem go make yu dey save for anytin wey yu dey do and yu nor go ever fall. 3:24 Fear nor go katch yu wen yu dey sleep and yu go sleep well still day break. 3:25 Yu nor nid to worry about wahala wey go just happen, just as e dey go meet wiked pipol. 3:26 God go save yu and E nor go let trap katch yu. 3:27 Anytime wey yu fit, make yu do good to pipol wey nid am. 3:28 Nor ever tell yor neighbour make e wait till tumoro, if yu know sey yu fit help am naw. 3:29 Nor ever plan bad against yor neighbour, bikos doz wey dey stay near yu, trust yu. 3:30 Nor argue with pesin just bikos yu won argue, wen yu know sey e nor do yu bad. 3:31 Nor jealous or bigin bihave like pipol wey like wahala well-well, 3:32 bikos God hate pipol wey dey do evil, but E dey draw raitious pipol near body. 3:33 God don curse wiked pipol house, while blessings full raitious pipol own. 3:34 God nor get wetin E won do with proud pipol, but E dey favor pipol wey dey honbol. 3:35 Pipol wey wise go get good name, but fools go only add trobol join dia disgrace.